President Tinubu touch on di youth, security and economy for im Independence Day broadcast, To put togeda a 30-Day National Youth Confab

Wia dis foto come from, BayoOnanuga/X
Meanwhile, Nigeria President Bola Tinubu don announce di gathering of a National Youth Conference to address di different challenges and opportunities wey dey face young pipo for di kontri.
President Tinubu tok wen im address di nation for im second Independence Day Broadcast and Nigeria 64th anniversary say di conference go "provoke meaningful dialogue and empower our young pipo to participate actively in nation-building."
E say dis go dey possible by by ensuring say dia voices dey heard in shaping di policies wey dey impact dia lives.
Di Confab go last for 30 days and e go touch on issues like education, employment, innovation, security, and social justice.
Di president add for im address say di details of di Confab and selection of di delegates go dey designed in close consultation with di young pipo through dia representatives.
Oda youth-centric programmes wey di president say di administration dey do na di 3 million Technical Talents programme (3MTT) of di Ministry of Communications, Innovation and Digital Economy, wey dey aimed at building Nigeria technical talent.



