Spain defeat England to win Women's World Cup 2023

Spain make history as dem defeat England to win dia first ever World Cup.

Live Coverage

Jelilat Olawale

  1. Spain 0-0 England

    Jess Carter kick one forward, Ella Toona make run for am but Cata Coll take am back sharparly.

  2. Lauren Hemp get rattle early on as England try to get on di attack as di match start.

  3. KICK-OFF

    Di match don start

  4. Kontri wey don win di cup so far

    1991:USA

    1995:Norway

    1999:USA

    2003:Germany

    2007:Germany

    2011:Japan

    2015:USA

    2019:USA

    2023:?

  5. Fotos from di World Cup closing ceremony

    Fotos from di Fifa World Cup closing ceremony

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Di closing ceremony of di World Cup don start. Di ceremony go include live music sets, dancing, light shows among oda tins

    Fifa World Cup closing ceremony

    Wia dis foto come from, Getty Images

  6. LINE-UPS, Ballon d'Or holder Alexia Putellas dey on di bench

    Spain don announce say Salma Paralluelo, di teenager who come off di bench to score for di quarter-finals and di semi-finals, go start.

    Ballon d'Or holder Alexia Putellas dey on di bench. Barcelona playmaker Aitana Bonmati go start.

    Spain XI: Cata, Batlle, Paredes, Codina, Olga, Abelleira, Bonmati, Hermoso, Redondo, Caldentey, Paralluelo.

    Spain team

    Wia dis foto come from, Getty Images

  7. LINE-UPS, Toone dey start for England, James dey on bench

    England team

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Sarina Wiegman don name di same England starting XI wey means Lauren James, wey dey return from a two-match suspension, go dey on di bench.

    Ella Toone go keep her place for di side and England set-up with a back three again.

    England XI: Earps, Bronze, Bright, Greenwood, Carter, Daly, Walsh, Stanway, Toone, Hemp, Russo.

    Subs: Charles, James, Nobbs, Hampton, Wubben-Moy, Morgan, Coombs, Kelly, England, Zelem, Roebuck, Robinson.

  8. Who go make history maker between England and Spain?

    62 matches.

    31 days of competition.

    30 teams gone.

    Two remain.

    England fit carry di cup or na Spain go write dia name for history?

    Good morning and welcome to di live coverage of di Fifa Women’s World Cup 2023 final.