Buhari don approve 12,000 metric tonnes of food to affected states

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
Nigeria President, Muhammadu Buhari don approve di release of 12,000 metric tonnes of food items from di National Strategic Reserve.
Dis na for distribution to communities wey dey affected by flooding across di kontri.
National Emergency Management Agency don begin di transportation of dis items to di affected States.
