You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Inec suspend announcement of Kogi State Govnorship results until Monday

Latest results from Bayelsa and Kogi Govnorship elections wey Independent National Electoral Commission announce dey inside hia.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Onyinye Chime

  1. Election suppose be secret ballot

    Secret ballot na di wen voter secretly choose who im wan vote witout anybody seeing wia im put hand.

  2. Evriwia peaceful as Kogi pipo dey cast dia vote

  3. Bayelsa election staff dey set up for voting

  4. Di govnor vote for im ward for unit 11 Okeneba Agasa Ahache ward for Okene local government area

  5. Kogi Govnor Yahaya Bello don vote

  6. Voting don start for Kogi state

  7. Road empty, Security evriwia as election dey start for Bayelsa

  8. Bayelsa elections: Bayelsans don redi to vote, Bayelsans dey redi to vote

    Bayelsa pipo dey wait to choose who go be dia Governor for di next four years.

    According to di Independent National Electoral Commission INEC, Bayelsa get 923,182 registered voters, 8 local goment, 105 registration areas and 1804 polling units.

    Na 45 political parties dey participate for di election with 43 male and 3 female candidates.

    Di pipo dey ginger say di election go go well so many of dem travel go dia communities wey dey di riverine communities do dem fit cast dia vote after di state goment declare public holiday on Friday 15 November.

  9. Kogi: Di battle ground don set

    According to di political calculation and di ethnic wahala wey dey ground, analyst believe say na 7 local goment out of di 21 local goment go be tough battle ground between Yahaya Bello and im rival Musa wada.

    Bello come from Kogi Central wey and di local goment under am na Okene, Adavi, Okehi, Ajaokuta, and Ogori-Magongo and e dey expected say e go get block vote for im area except for Okehi wia Natasha Akpoti of SDP come from.

    And for Wada, e come from Kogi East and di local goment under am na Ibaji, Ofu, Dekina, Ankpa, Olamaboro, Igalamela, Idah, Bassa, and Omala.

    Wada go show strength for im area because of di Igala unity but e fit no get block vote sake of say Governor Yahaya Bello running mate, Edward Onoja come from dat area.

    And so di battle area go be di western senatorial district wey get di following local goment: Ijumu, Yagba East, Yagba West, Lokoja, Kogi/Koto Karfe, Kabba/Bunnu and Mopa-Moro.

    Any of di candidate wey get majority vote for dis area fit win di governorship election for di state.

    And di important tin be say na for dis Kogi West Senatorial District na dem dem do rerun election for PDP’s candidate Dino Melaye and APC Smart Adeyemi afta Election Tribunal Petition cancel di before election wey declare Dino as winner.

  10. Kogi Election: Kogites don ready to choose dia leader

    Day don break and di pipo of Kogi state north central Nigeria don ready to choose who go lead di state for di next four years

    Na 24 candidates dey contest for di post of governor but di main fight na between di ruling All Progressive Congress candidate, Gov. Yahaya Bello and di Peoples Democratic Party, Musa Wada.

    Na about 1.6 million kogite na im Inec bin register and so far 93 percent of dis number already get dia voters card to vote for di 21 local goment area of di state.

    Di state get about 3,058 voting point wey kogite go line up to vote and for every of di polling unit, six policemen plus oda security agents dem go dey ground to protect di pipo and di electoral materials.

    ����� �Z�n1>

  11. Welcome!, Una good morning,

    Dis na BBC Pidgin coverage of di Bayelsa and Kogi elections. we go bring una all di latest tori from di two elections as e dey happun.