You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Inec suspend announcement of Kogi State Govnorship results until Monday

Latest results from Bayelsa and Kogi Govnorship elections wey Independent National Electoral Commission announce dey inside hia.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Onyinye Chime

  1. Bayelsa State governor Seriake Dickson don cast im vote for Toru Orua, Sagbama LGA

  2. Former Nigeria presido Goodluck Jonathan say voting for im ward start late

    Former Nigeria president Goodluck Jonathan no dey happy say voting for im ward start late.

    Oga Jonathan wey also bin serve as govnor for Bayelsa State from 2005 to 2007 say as of 8:19am wey e reach im ward to vote nobody bin dey ground.

    Im say as Nigerians "we no suppose to do tins anyhow and expect di best."

    Im add say make pipo for Bayelsa and Kogi ensure say di elections go peacefully as dem no go fit conduct elections for crisis situation if dem really want good leaders.

  3. Kasala don burst for Dino Melaye polling unit

    Dem don shoot one pesin afta katakata start for Senator Dino Melaye polling unit.

    Less than one hour afta e comot from di voting unit, some jaguda pipo for two Hilux vans and Honda Civic storm di place begin shoot for air.

  4. Inec suspend election for Ologi community for Bayelsa

    Supervising Electoral Officer for Ogbia LGA, Nkwachukwu Orji say, even though di election dey generally peaceful for di LGA, place like Ologi community bin get katakata.

    For Ologi community, area pipo bin no wan do election so dem pack all do materials wey dem suppose send go some polling unit burn dem.

    dem don suspend election for di community.

  5. Oga Jonathan no happy say election start late for im ward

  6. Jonathan as e dey cast im vote

  7. '...having served dem (Kogi pipo) well well, dem go decide to renew my mandate'

  8. Goodluck Jonathan cast im vote

    Afta plenti delay, former presido Goodluck Jonathan cast im vote for Otuoke.

  9. Update for Kogi East election

    Na total lock down for Ayingba, Dekina local goment for Kogi East Senatorial District.

    Afta im cast im vote, Peoples Democratic Party candidate Musa Wada, alledge say di work of APC chief jaguda pesin wey from di area na to snatch ballot box plus chase voters away.

  10. Kogi female candidate Natasha don finally vote

  11. Distribution of materials don begin for Otuoke

    Few minutes past 11am na im materials take reach ward 13 unit 39 for Otuoke, di polling unit of former President Goodluck Jonathan.

  12. Men wit military uniform attack Obeiba ward 1

    Female candidate Natasha Akpoti say military men attack dem for her polling unit for Code 19, Obeiba Ward 1, Okehi local government.

    Some agents cari wound for head sake of di attack.

    According to her, di suspected military men attack afta pesin wey dem suspect to be APC agent bin wan use one voter card and im no gree, den dem begin beat am.

  13. Dino Melaye don do acreditation

  14. Katakata for Natasha ward

    Katakata don burst for Obeiba ward 1, di ward of di only female govnorshi candidate for Kogi.

    Natasha Akpoti dey fear to comot from her house go her polliing unit.

    SDP agents chop beating and dem kidnap odas for Obeiba ward 1.

  15. Update on Bayelsa

    Election don begin for unit 5 ward 8 Imiringi, but materials neva reach all di polling units including Otuoke for Ogbia LGA.

    Materials reach polling units for former Nigeria president Goodluck Ebele Jonathan ward for Otuoke.

    Officials for Otuoke RAC centre say say dem just dey finish to sort di material.