You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Who be di ogbonge Kenyan lawyer Judy Thongori wey die?
Many Kenyans and legal practitioners including President William Ruto don begin dey send condolence messages to di family of ogbonge lawyer Judy Thongori wey die.
On Wednesday morning, pipo for Kenya bin wake to di news of di death of dis ogbonge lawyer wey dem describe as human rights advocate wey don touch lives of odas.
Kenya President William Ruto say di lawyer bin dedicate her life to family law for di kontri wen she dey alive.
"Her dedication to family law and human rights touch many lives and leave lasting impact on our society," Ruto tok for im statement.
As President Ruto say late 'Judy kindness, wisdom and service go dey deeply missed and remembered', several Kenyans don dey pour in dia condolences.
Faith Odhiambo wey be di 51st President of di Law Society of Kenya say di contribution of Thongori and her impact go remain for di legal profession.
"Dis morning, di legal fraternity mourn di loss of a distinguished member and beacon of excellence. Judy Thongori SC na monument of legal prowess and exemplify all di qualities of a professional North Star.
"Her noteworthy contributions to family law and human rights dey timeless and continue to propagate a learning curve for many for di profession. Di legacy she leave behind go remain indelible mark of her impact wey go live on among us, she tok.
Odhiambo send condolences to di family and pray make dem heal and find comfort.
Di Council of Legal Education for Kenya wia Thongori don serve bin also send dia condolences as dem describe di kain pesin wey she be for di legal profession.
"We dey deeply saddened by di demise of SC, Judy Thongori. Her dedication and commitment no get any match and di legal profession don lose epitome of excellence and professionalism," according to di statement by di council.
Wetin cause her death
According to tori, na small illness bin lead to di death of dis legal professional wey don spend most of her life to fight for family law reform for Kenya.
Di death still dey shock some legal pipo for Kenya.
Who be Judy Thongori?
Judy Thongori na ogbonge family and human rights lawyer for Kenya wey don contribute to different aspect of di law profession for di kontri.
Ms. Thongori bin previously serve for di Council of Legal Education as council member wia she contribute to regulate legal education and training for Kenya
Di 15th Chief Justice and President of di Supreme Court of Kenya, Hon. Justice Martha K. Koome, describe Thongori as one of Kenya most distinguished legal practitioners.
Ms. Thongori na trailblazer for di legal profession and a passionate advocate for justice for di matters wey dey affect families, women and children.
For di early 2000s, Thongori bin lead di Legal Department of FIDA-Kenya wit unmatched dedication and brilliance wia Hon Justice Koome bin serve as Chairperson.
Wen Thongori dey FIDA, she dey instrumental to di law wey dey protect di rights, interests, and dignity of vulnerable women, children and di family well-being.
She also dey strong for Family Division of di Kenya High Court wia she advocate for family law reform.
Wen Thongori begin private practice, she become one of Kenya foremost family law practitioners.
For November 2024, Thongori speak for di Supreme Court at 12 Conference, wia she lead panel discussion on family law.