How UK deputy Prime Minister, Labour Party working-class warrior Angela Rayner fall from power

Deputy Leader of di Labour Party Angela Rayner listen to speech to main hall on day four of di Labour Party conference on 28 September 2021 for Brighton.

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Joshua Nevett
    • Role, Political reporter
  • Published
  • Read am in 6 mins

Until dis week, Angela Rayner dey considered to be one of di most powerful women in Britain, a deputy prime minister wey many don begin see as future candidate for di top job inside politics.

She describe her sef as "proper working-class" woman, Rayner grow up for poverty and leave school without any qualifications at 16. She enta high office for her landslide election victory.

Na remarkable journey.

But Rayner extraordinary rise to di height of British politics wit di Labour Party don also lead to ogbonge fall.

She resign as deputy prime minister and housing secretary afta she gree say she no pay enof tax on her new house wey she buy.

She don also resign as deputy leader of di Labour party.

E mean say she go return to di backbench for a high-profile MP wey dem bin consider to be big political asset to her party and wey remain a popular figure within many Labour circles and beyond.

Her inspiring story, personality, and ability to connect wit parts of di voters wey no fit easily assess oda politicians, give her special status for Prime Minister Sir Keir Starmer cabinet and confam why e go dey hard to replace her.

Tough upbringing

Born Angela Bowen for Stockport, Greater Manchester, in 1980, Rayner grow up for one of di area poorest council estates and from an early age, dey care for her mama, wey get bipolar and suffer from depression.

Both Rayner parents no get work and wen she dey tok for 2017, she remember how she gatz grow up very quickly.

"My mama na really vulnerable pesin. I remember, at 10, my mama bin dey reason suicide and me dey sleep like dog for di end of her bed, just to try and to dey next to her so she no go wound hersef," Rayner tok.

She don also recall how she bin dey go her grandmama flat on Sundays, so di family fit baff turn by turn dia. Hot water too cost for dem to use for house.

Labour shadow education secretary Angela Rayner dey tok for one general election campaign event for Manchester on 7 November 2019. She hold her hands out in front of one red screen.

Wia dis foto come from, Reuters

Rayner dey usually tok about how dem tell am say she "no go ever amount to anytin", afta she leave school without any qualifications.

But afta she born her first pikin at 16, Rayner study part-time for college, learn British sign language and get vocational qualification for social care.

She spend some years as a care worker for Stockport, mainly dey look afta old pipo for dia house, just as she dey also rise for di union, Unison.

She don also describe hersef as "mouthy", pesin wey "no dey take nonsense form management".

Angela Rayner wit members of Unison and protesters from Save Our Ambulance Service on dia way to di Department of Health. Dem hold one purple sign wey read Unison.

Wia dis foto come from, Alamy

In her 20s, she become full-time union official and eventually, afta battles over working conditions and zero-hour contracts, rise to di most senior elected role for Unison and north-west England.

Na for Unison she meet Mark Rayner, one fellow union official wey she marry for 2010 and divorce for 2023. Di couple get two sons, one wey dem born premature to di extent say dem register am blind and e dey get special educational needs.

She credit di trade union movement, say dem encourage her to enta politics and carry her from - in her own words - "di girl on a council estate" to "woman wey feel like she fit conquer di world".

Dose ambitions start to dey happun for 2015, wen she win election as di MP for Ashton-under-Lyne for Greater Manchester. She later say she bin only stand to make di point say "pipo like me no fit win election" and don "accidentally" win di seat.

Di Prescott role

Rayner rise quickly for Westminster, she take up di women and equalities, and education brief on di shadow cabinet of former Labour leader, Jeremy Corbyn.

Wen Corbyn stand down in 2020, afta Labour worst general election result since 1935, Rayner run for di leadership, and she get di support of her ally Rebecca Long-Bailey, wey come second to Sir Keir.

Instead, Rayner stand for di deputy leadership and win election to dat post comfortably.

But relations between Sir Keir and Rayner for sometimes now don sour. Afta Labour lost control of eight English councils and lost di seat of Hartlepool for one parliamentary by-election for May 2021, dem remove di deputy leader from her post as party chairwoman.

She fight back and dem appoint her as shadow first secretary of state among oda titles.

By dat point, Rayner don get strong support base and a powerful role wey be like dat of John Prescott, wey pipo see as political bridge between di working class and di New Labour project during Tony Blair premiership.

Rayner heavily lean into dat role and try use am to her party advantage for di years before Labour general election win in 2024.

Labour Party leader Sir Keir Starmer and Angela Rayner, deputy leader and chairwoman of di  abour Party visit Seaton Carew seafront on 1 May 2021 for Seaton Carew.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For May 2021, dem remove di deputy leader from her post as party chairwoman

As pesin wey dey outspoken and confrontational at times, Rayner don repeatedly accuse di Conservatives say dem dey "out of touch", and don hammer di party wit lines like "one rule for dem and anoda rule for us" during di scandal ova pandemic parties for Downing Street.

Sometimes Rayner dey admit say she go too far, she once apologise for describing senior Conservatives as "a bunch of scum".

Her popularity plus di venom of her political attacks bin make her target of unwanted headlines.

For 2021, Rayner para at "sexism and misogyny" in politics, afta newspaper report say she cross and uncross her legs during prime minister questions to distract Boris Johnson.

And for 2024, police investigate her on top di tax she pay on di sale of her council house, again afta plenty reports by unfriendly newspapers, wey di Conservatives hail. Dem discover say she no commit any criminal offence.

Angela Rayner, deputy leader of di Labour Party tok on di final day of di Labour Party Conference on 28 September 2022 for Liverpool.

Wia dis foto come from, Getty Images

Her ability to brush through political controversies give her one air of untouchability, and some pipo don nickname her "Teflon Ang".

Days bifor her resignation, di prime minister bin mount one full-throated defence of Rayner, as e hail her as a "great story of British success" wey give working-class children "a real sense of aspiration".

And yet di political optics of one housing secretary tok say she no pay enough tax on her house no dey easy on di eye.

Rayner dey face charges of hypocrisy and calls for her to stand down.

She resign from govment afta di prime minister ethics adviser Sir Laurie Magnus declare say she breach di ministerial code.

While e say she bin "act wit integrity", e tell di prime minister say "dem no fit consider say she don meet di 'highest possible standards of proper conduct' as outlined by di [ministerial] code."

Afta she don overcome difficult upbringing and personal adversity to climb di heights of di Labour Party and become only di second ever deputy prime minister, Angela Rayner political career don come to a premature end within just 14 months of a Labour government.