Di 10 weakest currencies for di world for 2026

    • Author, Abdalla Seif Dzungu
    • Role, BBC Swahili
    • Reporting from, Nairobi Kenya
  • Published
  • Read am in 5 mins

US dollar na di currency wey pipo dey trade pass for di world, but e no be di strongest currency for di world (dat title na for Kuwaiti dinar now).

But if we check di oda side, di weakest currencies for di world wey dey trade for very low levels compare to US dollar.

According to Forbes magazine, some need plenty thousands of units just to buy 1 dollar.

Make you check di 10 weakest currencies for di world.

1. Lebanese book (LBP)

Lebanese pound na one of di weakest currency for di world wen you compare am to di US dollar. One Lebanese pound na $0.000011. E mean say, one dollar na 89,556.36 Lebanese pounds.

Lebanon dey near Mediterranean Sea, also dey share border wit Israel and Syria for Middle East.

Di kontri get service-based economy and dey export precious stones, metals, chemicals, food and drinks.

According to Forbes, Lebanese pound don dey face wahala against di US dollar for plenty years sake of economic decline, inflation and unemployment, banking crisis and political wahala.

2. Iranian Rial (IRR)

According to di currency converter wey Forbes dey use, one Iranian rial dey value 0.000024 dollar now, meaning sey one dollar fit buy 42,112.50 Iranian rials.

Di rial don dey since late 1700s. Dis currency don dey maintain dat exchange rate wit di dollar for many years.

Iran dey for Persian Gulf, between Iraq and Afghanistan.

E be major exporter of oil and natural gas, but economic sanctions don pressure di country currency well well.

3. Vietnamese Dong (VND)

As Forbes tok am, Vietnamese dong dey rank third for our ranking, and each unit of dia money fit buy you $0.000038.

E mean say wit $1, you fit buy 26,345 Vietnamese dongs. Vietnam dey near South China Sea and dia neighbors na China, Laos and Cambodia.

Services na di biggest part of dia national income, in fact na him be di measure of di kontri economic production, next na electricity, energy and cloth.

Di kontri finances don suffer from export wahala and decline for exports lately, plus long period wey interest rates for United States dey rise.

4. Laotian Kip (LAK)

Dem introduce di Laotian kip or Lao for di 1950s and na di fourth weakest currency, Dia 1 kilo be $0.000046. Dis one mean say one dollar na 21,663.26 lak.

Laos na landlocked kontri wey dey share border wit Vietnam, Thailand, Cambodia and China. E dey rely well well on export like copper, gold and wood.

Di kontri dey suffer from weak economic growth, plenty external debt and high inflation wey dey affect di Laotian currency.

5. Indonesian roupee (IDR)

Dem create Indonesian national currency in 1946. Worth of one rupee currently na $0.000059, which means say wit 1 dollar, you fit buy equivalent of 16,849.37 rupees.

Indonesia include more dan 17,000 islands for pacific Ocean, wey include Java, Sumatra and parts of Borneo and New Guinea.

On top matter of gross domestic product, di Kontri na di largest for Southeast Asia, na dia service sector dey drive di economy.

Indonesia also get large wealth of raw materials, but dia national currency don depreciate against oda currencies sake of combination of inflation and fear of recession.

6. Som Uzbek (UZS)

Dem introduce som for 1993 and e be one of di national currencies for Uzbekistan, di value na $0.00008. $1 na $11,861.84.79 som.

Uzbekistan na kontri wey dey for Central Asia, before now dem be part of di Soviet Union.

Dem be one of di big exporters of cotton and dem get plenty minerals, oil and gas.

According to Forbes, di kontri don do some economic reforms, but e still dey face low economic growth, high inflation, unemployment and plenty corruption.

7. Guinean franc (GNF)

Di Guinean franc come out for 1959 and e dey worth $0.000115 now. Dis one mean say one dollar na 8,658.25 Guinean francs.

Guinea na former French colony wey dey for sub-Saharan Africa.

E get plenty natural resources like gold and diamonds, but e dey face high inflation, soldier wahala and plenty refugees wey dey come from Liberia and Sierra Leone.

8. Burundian Franc (BIF)

Burundi na one landlocked kontri for East Africa, di worth of dia currency now na $0.00033, wey mean say one US dollar na 2,975.74 Burundian francs.

Di kontri get more dan 14 million pipo, e dey surrounded by Rwanda for di north, Tanzania for east/southeast and Democratic Republic of Congo for di west.

Coffee and tea dey make up 90% of wetin dem dey export.

9. Malagasy Ariary (MGA)

According to Forbes, dem create ariary for 1961, and di Malagasy mony replace franc officially for 2005. Now one ariary na $0.00021, wey mean say 4,637.73 ariary be one dollar.

Madagascar na one island kontri wey dey off di southeast coast of Africa.

Dia main sectors wey dey boost dia economy na agriculture, mining, fishing and forestry. Wetin dem dey export include vanilla, nickel and cloves.

10. Paraguayan Guarani (PYG)

Dem create am for 1952. Paraguayan Guarani dey trade for $0.00015 now, dat mean say one dollar na 6,619.11 Guaranis.

Paraguay no get seaport; e dey border Brazil, Argentina and Bolivia.

Di kontri be one of di main producers of soybeans, sugar substitutes, beef and corn.

Di currency dey under pressure from inflation, corruption and counterfeiting.