FG investigation find say no be Buhari but Tunde Sabiu give approval for naira redesign

Wia dis foto come from, CENTRAL BANK OF NIGERIA
Di Special Adviser on Information and Strategy to Nigeria President Bola Tinubu say di findings from di Central Bank of Nigeria (CBN) investigation wey di goment just conclude show say former president Muhammadu Buhari bin no approve di 2022 naira redesign.
Oga Bayo Onanuga tok dis one for X page as im dey react to di report wey special investigator, Jim Obazee, bin release give President Tinubu on 9 December.
Obazee report bin sama some major allegation on former CBN Govnor, Godwin Emefiele plus 13 oda pipo.
One of di allegation be say former president bin no give Emefiele any approval to change di design of di naira.
According to di report, na one of Buhari former aide and nephew, Tunde Sabiu, wey bin first give Emefiele di idea to redesign di naira for September 2022.
On October 6, 2022, Emefiele write to Buhari say im wan redesign and reconfigure N1000, N500 and N200 notes.
But according to di report: “Di former President bin follow body but im no approve di redesign as di law require. Buhari only approve say make dem print di currency for Nigeria. Dem only mention di redesign to di board of di CBN on December 15, 2022, after Emefiele award di contract to di Nigerian Security Printing and Minting Plc on October 31, 2022.”
Also, CBN bin print di new N200, N500, N1,000 notes at di cost of N61.5 billion out of which na only N31.8 billion e pay di Contractor, Obazee report.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Naira redesign fraud
According to di report from di special investigator, di controversial naira redesign wey President Buhari bin no approve according to provisions of section 19 (1) of di CBN Act, 2007, bin also be fraud.
Di bank under Emefiele bin spend N1.73 billion on some kain fees for 19 cases wey di investigate trace directly to di Naira Redesign and reconfiguration agenda.
According to di report, dem pay 205,000 give one UK company for Naira Redesign effort - positioning of watermark, presence of QR codes, different numbering style, and oda complex security features.
Oda tins wey di investigate find
Di report also tok say dem discover 593 bank accounts for UK, US and China, where CBN under Emefiele bin keep Nigeria moni witout approval or authority to do so from di Board and Investment Committee of di bank.
Di investigate also find say di former top bank govnor and oda CBN officials bin allegedly withdraw cash of $6.23 million - at official rate of N461 to dollar - from di bank vault, at di official rate, under fake approval from di president to pay foreign election observers.
Oga Obazee recommend for im report make goment carry Emefiele and at least 13 oda pipo wey include im deputy govnors, for alleged gross financial offences.
For UK, Oga Emefiele keep £543.4 million pounds for different fixed deposit accounts, di report allege.
Di report also tok say Emefiele manipulate di Naira exchange rate plus do fraud for di e-Naira project wey CBN bin do.
Oda fraud activities wey dey committed include: Fraudulent use of Ways & Means of up to N26.627 trillion, fraudulent intervention programmes, fraudulent expenditures on COVID-19, misrepresentation of presidential approval on NESI Stabilization Strategy Ltd., padding of former president Buhari approval wit N198.96 billion - approximating N801.04 billion to N1 trillion, No approvals from di former president and yet dem take N500 billion come debit to Ways & Means, no approval for di breakdown of N22.72 trillion wey dem present to di 9th National Assembly to illegally securitize "Ways & Means" financing.
President Tinubu bin appoint Jim Obazee as special investigator to torchlight CBN and oda agencies wey relate to am.
Di president bin order am to set up team wey sabi and wey get experience to work wit am and wit relevant security and anti-corruption agencies for di assignment.
Oga Tinubu say im appoint Obazee base on Section 15(5) of di Nigeria Constitution and inline wit di kontri fight against corruption.
I also order Obazee make im give complete report of di kontri moni wey dey di hands of corrupt individuals and companies both public and private.













