Why kasala burst between Davido and Rarara for social media?

Rarara and Davido

Wia dis foto come from, Dauda Kahutu Rarara/Facebook, Amy Sussman via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Argument don burst for social media afta political singer Dauda Kahutu Rarara criticise popular Afrobeats star David Adeleke wey pipo sabi as Davido ova di outfit wey e wear go Fifa World Cup Countdown Concert for Los Angeles.

Davido don fire back at di Kano-based singer.

For di Fifa World Cup Countdown Concert, Davido wear one outfit wey carry di words "Bring Dem Home," plus di names of students and teachers wey kidnappers carry for Oyo State, southwest Nigeria.

Di action attract plenty international attention to di kidnapping problem wey dey worry Nigeria.

Rarara accuse Davido say e put di lives of kidnapped victims for danger by bringing global attention to Nigeria security wahala.

E tok say: "Wetin Davido do na crude behaviour. How e go expose Nigeria secrets to di whole world? Why e go give publicity to insurgents? Na dis insurgents kidnap di students so security agencies go release dia pipo, and govment still dey try rescue di children witout releasing dem. For dis critical time, Davido kon expose our security mata to di whole world during di World Cup."

Rarara still allege say Davido do am bicos of political loyalty and link di action to politics for Osun State.

Later, Davido respond through im X account, wia e use di word "Debidoo" take joke or mock di way Rarara pronounce im name.

For anoda statement, Davido insist say Nigerians no suppose keep quiet about security problems just to protect political interests.

E add say real patriotism na to tok di truth about problems wey dey affect society, and e call on Nigerians make dem put di interest of Nigeria above politics and personal interest.

Dis response make di argument hot pass among dia supporters.

While some pipo support Rarara view say Nigeria image suppose dey protected, plenty pipo support Davido.

Dem tok say di musician only use im international fame take draw world attention to di kidnapping crisis wey dey happun for Nigeria.

Social media users divide into two groups. Some tok say Rarara suppose focus more on di fight against insecurity, while odas accuse Davido of disrespecting Hausa language through im response.

Dis na how X users react:

@Oladejiakinn tok: "Reason no dey for Davido to wear dat dress. Why? bicos e no solve anytin. Govment know say dem fail dose kidnapped victims. Wearing dat kain dress only put Nigeria for bad light."

"Nigeria already dey for bad light. Wetin remain again? International media don report di kidnapping mata bifor Davido wear di shirt. Make una find place sidon abeg," @NajibHaruna_ tok.

@abubakarNetty tok: "A closed mouth na closed destiny. If you get problem, find solution by any means possible."

"Dear Davido, on behalf of educated Northerners, I wan make am clear say we no share Rarara views. Wetin e dey do and wetin e tok no represent us," @ibrahim94123763 tok.

@abbkar_ai tok: "I no dey support Rarara, but Northerners suppose understand say Davido no dey do dis becos of di whole kontri."

Who be Davido?

Davido, wey im full name na David Adedeji Adeleke, na Nigerian-American singer, songwriter, record producer and actor. Dem born am on 21 November, 1992 for Atlanta, Georgia, United States, to Nigerian parents Adedeji and Vero Adeleke.

Davido na one of di most successful musicians for Nigeria and Africa, wit plenty hit songs.

Im papa, Adedeji Adeleke, na businessman and philanthropist from Ede, Osun State. Im mama, Vero Adeleke, na university lecturer bifor she die for 2003.

Davido grow up for both Nigeria and America. E attend British International School for Lagos bifor e move go Oakwood University for Alabama to study Business Administration. But e leave school to pursue music career and return Nigeria for 2011.

E later attend Babcock University for Ogun State, wia e bag Bachelor of Arts degree in Music.

Who be Rarara?

Dauda Kahutu Rarara, wey dem born on 13 September, 1986 for Katsina State, bicom famous through im songs wey support APC during Nigeria 2015 general elections.

Im music help di APC campaign well-well.

Rarara na popular Hausa singer and songwriter. Many pipo sabi am as political praise singer bicos e rise to national fame during di 2015 general elections through im campaign songs for former President Muhammadu Buhari and APC.

Till today, e still remain one of di major voices for Nigeria political music.