Kwaito pioneer Doc Shebeleza don die aged 51

Wia dis foto come from, Getty Images
Kwaito pioneer Doc Shebeleza, wey im real name na Victor Bogopane don die, family confam.
Doc Shebeleza die for hospital at di age of 51 afta e battle wit long illness.
Na for June 2024, tori come out say di ogbonge don land for hospital sake of health scare.
Dis dey happun one day afta South African actress and singer Winnie Khumalo die.
Di Afropop singer dey known for her long musical career wey start for di 1980s, she also feature for popular South African TV series.
She dey best known for her hit song Live My Life and she don collabo wit popular South African artists wey include late Brenda Fassie.
Her sister Tshepi Akeepile tok say di singer die on Tuesday on di way to hospital.

Wia dis foto come from, Getty Images
Shakes Mavundla wey dey tok on behalf of im family tok say Shebeleza die on Thursday morning.
Tori be say di music icon bin don dey admitted in di Intensive Care Unit (ICU) for one private hospital for Johannesburg wia e undergo surgery.
Di cause of im sickness bin no clear.
Di album bin produce several hit tracks, wey include Kum'nandi, Ebumnandini and Ghetsa Ghetsa.
During di 1990s, e start di all-male group Amaskumfete, wey become popular for hits like Tsipa Tsipa.
Fans enjoy Doc Shebeleza music well-well, as e weave personal experiences, relationships, struggles and joy into im lyrics, wey dey create powerful connection wit listeners.
Im influence on di kwaito genre dey very thoughtful, as e inspire artists like Mandoza, Mapaputsi and many odas.
In later years, Shebeleza devote himself to philanthropy through im organisation Amaha, wey dey work to uplift im fellow artists.
Im legacy dey underscored by di 2014 hit song Doc Shebeleza by Cassper Nyovest. Di track no only become chart-topping success but e also serve as testament to Shebeleza influence across generations.
Shebeleza rise to prominence wit im debut album S'Kumfete wey e release on cassette for 1996.









