Death of rapper Oladips - Wetin we know

Oladips

Wia dis foto come from, Twitter/@oladipsoflife

Published

Nigerian rapper, Oladips wey im real name na Oladipupo Olabode Oladimeji don die?

Di tori break say im bin die around 10pm on Tuesday night, according to statement wey im management release.

Di statement claim say, "for ova two years im bin keep im battles to imself," even as dem express shock ova im passing.

Fans of Oladips bin dey wait for im debut album, even as di song "Ajala Travel" carry Oladips name go round.

Dis na just ova one month afta di death of im industry colleague Mohbad wey make Oladips sing di song "Die Young".

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Oladips bin get troubling posts for im social media a little ova an hour before im family say im die.

E post two tins for inside im Instagram story wey cause pipo to dey worry.

Di first one na when e enter Insta stories to hala im friend, Rasheed say, "Please wia are you? I don call your number taya. I tok say make una no dey leave only me for dis house. I don tok dis tin like a million times."

E add say, "Even dis period like dis, please come house".

Shortly afta, e post video wey e bin dey tell di Rasheed guy make e carry am dey go hospital wit wetin sound like cry for im voice.

Dat go be di last tin wey im post before im family go announce im death.

Around two hours following di initial Oladips story, im friend wey im mention, Abdul Rasheed respond for im own stories say, "abeg I dey on motion, im mama say make I no carry am go hospital, say make I carry am come house."

Oladips life story

Oladips bin reveal say im go drop im debut album before di end of di year.

For inside interview e tok say im bin dey wait for di whole mata wit Mohbad before im release am.

E bin no announce di date for di album sake of say im plan na to drop di album wey im call Super Hero Adugbo just like that without anticipation.

E also bin promise for social media say im go get concert dis year for December.

Di 28 year old rapper na papa of one pikin - daughter wey im dey call Paris.

Di star don work wit oda celebs like Zlatan, Mayorkun and Olamide.

E bin formerly dey signed to Reminisce record label but im tok say e comot di label afta dem no promote di song im do with Mayorkun or shoot music video.

For 2017, Oladips blow afta im release im hit song Lalakukulala wey im feature Reminisce inside.

Stars like Odumodublvk and Chinko Ekun don dey show am love for inside social media.

Chink Ekun write for X say, "Oladips, RIP my beloved".

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2