All di charges against Omoyele Sowore wey court don remand for prison

Omoyele Sowore sitting for inside court during one of im trials
Wetin we call dis foto, Sowore na human rights activist wey also run for office of di president for di 2019 and 2023 general elections for Nigeria
Published
Read am in 5 mins

Nigeria human rights activist Omoyele Sowore go dey right now for di Kuje correctional facility for di kontri capital, Abuja, afta one judge revoke im bail for one of di court mata wey di govment sama am.

Justice Mohammed Umar tok say Sowore bin deliberately refuse to come to court one of di days for di hearing, and e no give any excuse for im absence.

Dis mata na di cybercrime accuse wey di Department of State Service (DSS) bin sama Sowore, as dem tok say di human rights activist bin call di President of Nigeria, Bola Tinubu, criminal.

Sowore deny di allegations and di mata dey go on for di Federal High Court for Abuja.

On Monday, Justice Umar give order make dem hold Sowore for Kuje prison and na from dia e go dey attend im trial. Di trial judge also refuse to comot im hand from di mata afta Sowore accuse am of bias.

Some human rights and Civil Society Organisations like Amnesty International and di Socio-Economic Rights and Accountability Project (Serap) don condenm Sowore recent detention and demand make govment release am.

However, apart from dis cybercrime mata wey land Sowore for prison like dis, e get oda court gbege wey Sowore dey face for court on top several accusations wey im don deny.

Dis na some of di court cases ontop Sowore head:

Kayode Egbetokun vs Sowore

Sowore bin get plenty gbas-gbos wit di former Inspector General of Police, Kayode Egbetokun, who e dey always call "illegal IGP", as e disagree wit how President Tinubu bin extend Egbetokun tenure as IGP even wen e suppose don retire.

In response, di former police chief arrest Sowore in October 2025 and sue am to court on top allegations of cybercrime.

Di mata go on until February 2026 wen Egbetokun resign from office, and about one month later, di court strike out di mata.

Sowore vs Kayode Egbetokun

Afta di court strike out di mata wey di former police oga sama Sowore, di human rights activist den file im own mata for court against Egbetokun.

For di case, Sowore ask court to order Egbetokun to pay am 1.2 billion naira ($877,250) sake of illegal detention and violation of im fundamental human rights in October 2025.

Dis mata still dey go on for di Federal High Court Abuja.

Nigeria police vs Sowore, Emmanuel Kanu, Aloy Ejimakor

Collage image of Omoyele Sowore and Nnamdi Kanu

Wia dis foto come from, Sowore/BBC

Wetin we call dis foto, Sowore bin protest for di release of Nnamdi Kanu, a separatist leader wey court later sama life imprisonment on top terrorism charges

Also e get di ongoing court mata wey di police file against Sowore, Emmanuel Kanu and Aloy Ejimakor. Di mata dey go on for one Magistrate Court for Kuje, Abuja.

Emmanuel Kanu na di brother of Nnamdi Kanu, wey be leader of di separatist group di Indigenous People of Biafra (Ipob), and Aloy Ejimakor na Nnamdi Kanu lawyer.

Dis mata na sake of one protest wey Sowore bin organise to demand for di release of Nnamdi Kanu who di Nigeria govment dey prosecute dat tim on top terrorism accuse.

During dat protest, di police use teargas scatter evribody, come arrest Sowore, Kanu and Ejimakor and detain dem for dia cell, bifor dem later charge dem to court on top accuse of inciting public disturbance and breach of peace.

Di court also remand di three men for Kuje prison bifor e later grant dem bail even though police re-arrest Sowore dia for di court premises. Di main mata still dey go on.

Sowore vs Lagos State Police

Dis mata don conclude and na Sowore win am against di Lagos State Police Command and di Commissioner of Police for Lagos State dat time, Jimoh Moshood.

In November 2025, Sowore announce say e go join di residents of Oworonshoki area of Lagos State to protest against di demolition of buildings wey di Lagos State govment bin dey carry out for di area.

Sake of dis di police declare Sowore wanted and tok say if e enta Lagos, dem go arrest am on top accuse say e dey plan to cause public unrest. Sowore still enta Lagos and join di protest.

Later, e sue di Lagos police and dia oga, Jimoh Moshood and ask court to order dem to pay am N500 million damages as dem declare am wanted witout an invitation, arrest warrant or court order.

Di court agree wit di human right activist and order di police to pay am N30 million in damages instead of N500 million wey e bin ask for.

E neva clear weda di police don pay Sowore dat moni or weda dem appeal dat judgement wey Justice Musa Kakaaki of di Federal High Court Lagos bin deliver for February dis year.

Who be Omoyele Sowore?

Sowore stand from di roof of car during im presidential campaign for di 2019 election

Wia dis foto come from, Omoyele Sowore/Facebook

Na since im university days for di University of Lagos wey Omoyele Sowore don dey do activism, wia e start as a Student Union president for di 1990s.

E organise students protest against di military govment wen Head of State Ibrahim Babangida cancel di general election of June 12, 1993.

Sowore na from Ilaje land for Ondo State, South West Nigeria, and dem born am on February 17, 1971.

E be di founder of Sahara Reporters wey e tok say e start am for 2006 inside one small room for Manhattan, USA.

Sowore get Bachelor's Degree in Geography and Regional Planning from Unilag, even though e chop two extra years for di University (1989-1995) sake of im activism.

E also get Master's Degree in Public Administration from Colombia University, for di US.

E run for di office of President of Nigeria on top di political party wey e also form, di African Action Congress (AAC) for di 2019 and 2023 general elections.