Suki Waterhouse and Robert Pattinson dey expect dia first child

Wia dis foto come from, Getty Images
Congratulations dey in order for Singer Suki Waterhouse and actor Robert Pattinson, as di long time couple dey expect dia first child.
Di 31-year-old actress wey dey popular for her roles for di Huru series “Daisy Jones and di six" currently dey pregnant wit her first child wit di “Twilight” star.
Suki break di big news on stage, as she dey touch her baby bump and fans bin scream in reaction.
"I dey extra sparkly today as I reason say e fit distract you from something else wey dey go on," she tok as she begin dey sing for di Corona Capital Festival for Mexico on Sunday.
"I no dey sure if e dey work," she joke, she wear one shimmering dress.
Pattinson dey popular for di role of vampire Edward Cullen wey e play for di Twilight saga
Im fans react on top social media as dem hear say e go soon become papa.
"Robert Pattinson go soon get pikin and I no be di baby mama," one fan post on X, formerly Twitter.
End of Di one wey oda users dey read well well
"I no fit believe say Robert Pattinson go soon become a father," anoda fan tok.
Suki na actress and model. She meet The Batman actor, wey be 37-year-old for 2018.
Last month, she tell di Driven Minds: One Type 7 podcast say she pack comot her house dis year to go live wit Robert.
"I dey very lucky because e dey so accepting of di mess and di chaos. E no tok anything about am. E tink say e dey charming, so I dey very lucky for dat."
She tok about how dia dynamic as couple dey different to her previous relationships, she tok: "I get a life wey I dey proud of wey I wan share wit someone, and I dey stable."
BBC don contact representatives for di couple, wey never comment further on di news.















