You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
When workers go begin collect di new minimum wage after President Tinubu sign di bill into law?
Nigeria President Bola Tinubu don sign di N70,000 Naira minimum wage bill into law. E sign di bill on Monday for Abuja, Nigeria capital for middle of di Federal Executive Council meeting afta di National Assembly pass di bill.
E mean say e don become law for Nigeria say di lowest worker, domestic staff and odas no suppose earn below N70,000 naira.
According to Bayo Onaguga post for social media, di Head of Service for Nigeria say di new law go reassure di workers say di President cares about dia welfare.
Senate President Godswill Akpabio lead National Assembly leaders go di signing ceremony.
President Tinubu thank di National Assembly as dem pass am to law sharp sharp.
Dis dey come afta plenti dragging of leg between goment, labour unions, and di organised private sector for Abuja, as to wetin di new minimum wage suppose be in di face of di high cost of living for di kontri.
Wen workers go begin receive di new minimum wage?
Now wey President Bola Tinubu don sign di new minimum wage into law, wen dem go start to pay am?
According to President of di Nigeria Labour Congress, Comrade Joe Ajaero, di new minimum wage don begin count already.
For exclusive interview wit BBC Pidgin, oga Ajaero say di old minimum wage of N30,000 naira expire since 14 April, 2024 and for dem as labour union, di new minimum wage of N70,000 don start to count for workers already.
"Anytime wey goment wan start to pay di new minimum wage, we go ask for arrears we go start from 14 April 2024 and if you calculate am e don reach two to three months now.
So for us, we don begin count di new minimum wage, goment go back date am to 14 April, 2024." im tell BBC Pidgin for interview.
How we take reach hia
E don tey wey di labour and trade unions for Nigeria begin ask for review of di minimum wage.
Dem start di tok-tok wit di former administration under former President Muhammadu Buhari but di tok bin no get weight.
Di agitations to review di minimum wage begin carry weight afta President Bola Tinubu enta seat on 29 May, 2023.
Di call for di review double afta im announce say "subsidy don go", for im opening speech on swearing-in day, and cost of living begin dey go up.
Workers bin do protests and warning strike to draw goment attention to dia demands.
From dia, call for negotiations start but since Oga Tinubu bin neva appoint members of di Federal Executive Council (FEC) e bin hard for dem to know who exactly dem go follow tok.
Wen President Bola Tinubu inaugurate im ministers, di labour, trade unions and organised private sector begin meet. By dis time, fuel price don almost tripple.
Di trade unions request for N250,000 as minimum wage while goment say e too much make dem leave am for N60,000. But dem later increase am to N62,000 during di negotiations.
From dia, dem negotiate until e reach N70,000 even though govnors and private sector say e too much for dem to pay.
But on 18 May, 2024 President Bola Tinubu approve 70,000 naira ($43) as di new minimum wage for Nigerian workers.
E also promise say im go dey review di national minimum wage law evri three years sake of say na five years dem dey stay bifor goment bin dey review am.
E also promise to find ways to assist di private sector and di state goments to pay di money.
Na for inside one meeting wey e hold wit leaders of di organised labour unions – di Nigeria Labour Congress (NLC) and di Trade Union Congress (TUC) for di State House, Abuja e make di announcement.
Dis na 8,000 naira ($5) increase from di 62,000 naira ($38) di tripartite committee wey di President bin set up on minimum wage propose.
Di Minister of Information, Mohammed Idris announce di informate as e dey follow State House tori pipo tok.
Meanwhile NLC bin tell BBC say dem accept di N70,000 naira sake of say goment tell dem say if dem give dem di N250,000 wey dem dey request for, dem go increase di price of petrol. So e beta make dem reduce di suffering of Nigerians.
We dey update dis tori