Big Brother Titans show and why e dey cause tok-tok for Nigeria

Big Brother Titans

Wia dis foto come from, DSTV

Published

Reaction don follow di launch of one new reality TV show, Big Brother Titans wey start on Sunday, 16 January as Nigerians dey worry say e go affect di turnout of young pipo for di February presidential election.

Big Brother Titans na anoda version of di Africa most popular reality show franchise, Big Brother.

Di show dey see housemates from different part of Nigeria and South Africa dey battle to win a grand prize of $100,000 cash as dem try to keep viewers glued to dia TV with actions and drama.

Organisers say di show na di join togeda of two ogbonge shows - BBNaija and BB Mzansi TV reality show.

Meanwhile, as Nigeria elections dey approach, some Nigerians don condemn di show say e go be distraction for youth to actively participate for di upcoming election.

'Big distraction'

Ova time, statistics don show say many young pipo dey watch di BBNaija version of di show and e dey obvious from dia discussion on social media since di show start.

Reports say labour party, wey im supporters na mostly youths, don allege say di new reality show dey targeted to distract Nigerian youths from casting dia votes on di election dates.

For one interview wit tori pipo for Daily Post, Nigerian singer/songwriter, Charles Chukwuemeka Oputa, wey dem popularly sabi as Charly Boy, ask di youths to dey more concerned about wetin dey boda dem.

”I expect young pipo to face wetin dey face dem, Big brother no be wetin dey do us”, im tok.

”Make dem just concentrate on wetin dey face dem, wen dem finish dia voting dem fit face Big Brother. Voting suppose be everybody reality no be Big Brother.” Oga Charlie Boy add.

Addressing di issue, during di launch of Big Brother Titans, one of di host of di show, Ebuka say ”Nigerian youths dey very capable of going out to vote and also coming back to watch anything wey dem wan watch.”

Since di show launch on Sunday, #BBTitans na still di top trend for Nigeria twitter space plus oda social media platforms as pipo dey discuss di show and di housemates.

20 housemates na im dey di show dis year dey battle for di 100 thousand dollars cash prize.

Di show wey start on January 15 go last for three months.

Meet di housemates

Blaqboi

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Blaqboi na 26 year old wey come from Plateau State for Nigeria,and e dey live for Jos. Im be content creator and aspiring filmmaker.
Ebubu

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Ebubu, 28,  na from Anambra State for Nigeria, but im dey live for Lagos. Im be  actor and model.
Ipeleng

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Ipeleng be 24 years old and she come from di North West, and currently dey live for di Gauteng province for South Africa. She be law student.
Jaypee

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Jaypee, 26, na nurse and model and she come from Lagos State, Nigeria.
Jenni O

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Jenni O, 24, na Health and Safety specialist wey hail from Imo state for Nigeria but she dey live for di USA.
Juicy Jay

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Juicy Jay come from Eastern Cape for South Africa. Di 24-year-old na Semi-pro rugby player.
Justin

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, 21-year-old Justin come from East London, South Africa. Im be Photographer.
Kanaga Jnr

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Kanaga Jnr na from Abia State for Nigeria. Di  23-year-old aspiring actor dey live for Lagos wia im dey work as model.
Khosi

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Khosi na Journalist from KwaZulu-Natal. She dey live for Johannesburg South Africa and she be 25.
Lukay

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Lukay, 31 na from KwaZulu-Natal, South Africa. Im be sales executive.
Marvin

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Marvin na Chemical engineer and model. Di 28 year old originally come from Port Harcourt for Nigeria, and im dey live for Texas, USA.
Mmeli

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Di Content creator come from Hillbrow, Johannesburg, South. Africa. Mmeli be 24 years old.
Nana

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Nana, 22 na Entrepreneur wey come from Kaduna State, Nigeria.
Nelisa

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Nelisa, 25, wey originally come from Eastern Cape, dey live for Johannesburg, South Africa.
Olivia

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Olivia na 22 year old wey originally from Imo State, Nigeria. She be aspiring actor.
Thabang

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, 21-year-old Thabang na Sports data analyst. Im come from Soweto, but dey live for Johannesburg, South Africa.
Tsatsii

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Engineering, biotechnology, microbiology student Tsatsii na from Pretoria, South Africa. She be 24 years old.
Yaya

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Yaya, 30, na plus size model wey come from di Eastern Cape, but she dey live for Johannesburg, South Africa.
Yemi Cregx

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, Model and actor, Yemi Cregx na from Ekiti State in Nigeria. Di 30-year old dey live for Lagos State.
Yvonne

Wia dis foto come from, DSTV

Wetin we call dis foto, 28 year-old Yvonne na from Akwa Ibom State, now she dey live for Lagos, Nigeria. She be model and content creator.