FBI shoot and kpai man wey hold pipo hostage inside California bank

Wia dis foto come from, Jon Putman/Anadolu via Getty Images
- Author, Gift Andrew
- Published
- Read am in 3 mins
FBI don shoot and kpai one man wey bin dey hold plenti pipo hostage overnight inside one California bank.
Dis na according to di Bakersfield Police Department wey tok say dem kpai di suspect for "officer-involved shooting wey involve Federal Bureau of Investigation personnel" on Wednesday.
Di shooting na di end to a veri hectic time as di suspect bin lock imsef wit plenti pipo inside one multistorey Chase Bank building on Tuesday for Bakersfield.
At first, police bin go di area bicos of bomb threat.
Di tori comot on Tuesday, 2 June say one man hold plenti pipo hostage inside Chase Bank building wey dey for Chester Avenue and 17th Street, say di hostage taker carry bomb.
For statement, Bakersfield Police Department say dem receive call about bomb threat, say during investigation dem discova say di man barricade imsef inside di building wit several community members but nobodi don report any injury.
Di statement say police bin establish perimeter around di building and oda surrounding businesses to ensure public safety.
According to di statement, some members of di community manage escape from di area on time.
Bakersfield City Hall, di local police headquarters, nearby buildings and multiple roads bin dey closed during the hostage situation, as di police department negotiation team begin to contact di suspect via telephone.
"Evri single resource dey for di site disposal," Bakersfield Police Sergeant Eric Celedon tell di press on Tuesday.
"SWAT team, bomb squad, K9 team, gang unit, negotiators, drone team. Evri single asset we get to bring dis to di safest conclusion dey out here right now," e tok.
Police bin tell community pipo make dem stay away from di area and stay safe while dem dey try do peaceful resolution to di case.
Bakersfield na small city for Kern River, north of Los Angeles. E get population of less dan 500,000 pipo.










