How Nigerian politicians celebrate kontri 66th Independence Anniversary

A collage of Omoyele Sowore, Atiku Abubakar, Godswill Akpabio and Babajide Sanwo-Olu
Published
Read am in 5 mins

As Nigerians dey celebrate di 66th Independence anniversary many political leaders don chook mouth into di kontri govnance, economic growth and development.

President Bola Tinubu tok about im economic reforms as im ask Nigerians to dey confident in di kontri future.

"Wen I speak of prosperity, I no dey tok just about larger economy, abstract numbers or beta statistics. I mean somtin much more personal," Tinubu tok during im address.

'Our nation dey bleed' - Atiku Abubakar

Atiku Abubakar dey address pipo

Former Vice President of Nigeria Atiku Abubakar presidential candidate of di African Democratic Congress (ADC) criticise President Bola Tinubu economic policies as Nigerians dey celebrate independence day.

E tok say di administration policies don worsen di cost of living while dem refuse to provide Nigerians will any social relief program.

Inside im Independence Day speech, e tok say Bola Tinubu administration don dey ask Nigerians to endure for di past three years "more patience" and "more sacrifice" while govment officials dey " find money for dia own appetites".

Atiku compare di purchasing power of di minimum wage and di price of products for market for 2023 and 2026 afta Tinubu administration take ova di govment.

E say ₦30,000 minimum wage fit buy 118 litres of petrol for April 2023, while di new ₦70,000 minimum wage go fit buy only 50 litres today.

Atiku also argue say di prices of eggs and bread don affect wetin families fit afford as breakfast for morning and even wit di difficulties wey Nigerians dey face, govment still no fit protect dia lives.

"And beyond di market, our nation dey bleed. Armed groups don kill thousands of pipo and don push families comot from dia community. Farmers dey fear for dia farm. Parents dey fear for dia pikin to go school. Families dey fear wen dem go demand ransom for dia loved ones. Govment wey no fit make life affordable and no fit protect life don fail di two tests wey dey matter pass to di pipo," Atiku tok.

As Nigerians dey celebrate independence day, Atiku tok say im go protect dia votes for di forthcoming elections.

E tok say im go strengthen Independent National Electoral Commission (Inec) if Nigerians support am and ensure say inec quick publish result across all polling units and stop vote-buying.

'We no fit dey celebrate independence while our pipo trap inside poverty' - Omoyele Sowore

Omoyele Sowore

Di presidential candidate of di African Action Congress (AAC) Omoyele Sowore say as Nigeria dey mark 66th Independence Anniversary, concerns dey weda di kontri don fulfil di promises of freedom, dignity, prosperity, justice and equality wey dem make to Nigerians during di 1960 independence.

"We no fit dey celebrate independence while our pipo trap inside poverty, hunger, unemployment, insecurity, darkness, and hopelessness," Sowore tok.

Sowore also criticise di state of education, healthcare and electricity as e accuse pipo wey dey manage public resources of corruption.

"We no fit call oursefs truly independent wen our children dey denied quality education, workers dey earn wages wey no fit sustain dia families, hospitals dey collapse, di paltry electricity wey dey exist remains a luxury, and dose wey dey entrusted wit public resources dey loot wit impunity," e tok.

Godswill Akpabio say make Nigerians unite

Godswill Akpabio

Nigeria Senate President Godswill Akpabio for im Independence Day message ask Nigerians make dem unite and believe in di future of di kontri.

Akpabio call on Nigerians to renew dia vow to each oda and make di nation unite strongly across all religion and culture.

E also pay respect to di Nigerian Armed Forces for dia sacrifice to protect di kontri as im assure Nigerians say di National Assembly go continue to support President Bola Tinubu "efforts to strengthen di nation".

"We honour our founding fathers and di generations wey dia courage, labour and sacrifice make dis anniversary possible.

"Dem hand us a kontri to cherish and a future to build. May we prove worthy of dia faith, and may our children inherit a Nigeria wey go dey greater dan di one wey dem entrust to us," Akpabio tok.

'Our diversity na one of our greatest strength' - Babajide Sanwo-Olu

Babajide Sanwo-Olu

Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu praise Nigerians for dia resilience and commitment to build stronger nation as di kontri dey celebrate 66th Independence Anniversary.

Sanwo-Olu tok about Nigeria journey since October 1, 1960, di difficulties and di progress wey di kontri don make to overcome im challenges.

Di govnor tok say im get confidence in Nigeria potential, and add say di kontri diversity suppose be di kontri strength, no be source of division.

"Our diversity na one of our greatest strength, and e dey remind us of di richness of di nation wey we dey share," Sanwo-Olu tok.

"Make we honour di pipo wey don sacrifice dia best to build Nigeria by doing our own part evri day. Di heroes wey fight for our freedom believe say we go dey united, and we owe am to dem and our children to continue to dey work togeda."