Fotos: Burial of Anambra senator Ifeanyi Ubah

Carriage conveying Ifeany Ubah casket
Published
Read am in 2 mins

Di final interment ceremony of former Nigeria Senator, Ifeanyi Ubah, dey go on dis Friday for im hometown, Nnewi, in di Southeast region of di kontri.

Ubah die suddenly on July 27 dis year. President Bola Ahmed Tinubu describe im death as a "sad loss for di kontri.

Prominent pipo from di goment and also di business community all gada for Umuanuka Otolo Nnewi, Ubah hometown wia a Catholic requiem mass dey go on for di deceased politician.

Notably among dem na di former presidential candidate of di Labour Party for di 2023 general election and former govnor of Anambra State, Peter Obi; anoda former govnor of Anambra State and former Minister of Labour, Chris Ngige; Abia State Senator Enyinnaya Abaribe; Imo State senator Osita Izunaso and many odas.

Ubah dey survived by im wife Uchenna Ubah and dem born five children. E die at 52 years old.

Photos of Ifeanyi Ubah burial

Carriage wey carry Ifeanyi Ubah casket
During di church service for Ifeanyi Ubah funeral
Ifeanyi Ubah wife and children
Wetin we call dis foto, Ifeanyi Ubah wife and children
Peter Obi arriving for Ifeanyi Ubah burial
Senator Abaribe, Chris Ngige, Sen Osita Izunaso during Ifeanyi Ubah funeral church service
Ifeanyi Ubah family performing di dust-to-dust rite
Ifeanyi Ubah family performing di dust-to-dust rite