Arsenal fall flat wit 2-0 loss to PSV

Wia dis foto come from, Getty Images
Premier League leaders Arsenal miss di chance to seal top spot for di Europa League Group A as dem lost to PSV Eindhoven for Netherlands.
Di Gunners only need one point to go straight through to di last 16 next March.
But Joey Veerman first-time finish from 16 yards and a header by substitute Luuk de Jong - afta mistake by keeper Aaron Ramsdale on im European debut - see Mikel Arteta side lose for Europe for di first time dis season.
PSV, wey former Manchester United forward Ruud van Nistelrooy dey manage also score three goals wey ref disallow.
Gunners need to beat Zurich for dia final group game next Thursday for Emirates Stadium to guarantee a place in di last 16.
If dem fail to win and PSV com beat Bodo/Glimt for Norway, Arsenal go play two extra games for di knockout round playoffs wia teams wey finish third for di Champions League group stage go play.
PSV vs Arsenal highlight
FULL TIME: PSV 2-0 Arsenal
90mins: PSV clear Xhaka cross into di 18
End of Di one wey oda users dey read well well
89mins: Arsenal fans no beleive wetin dia eyes dey see for Eindovhen
87mins: Corner for PSV. Madueke put Gabriel under pressure wey hit di ball go corner
85mins: Saliba clear good cross from di right side by Til
83mins: SUBSTITUTION. Mauro Junior enta for Gapko
81mins: Arsenal don dey show a little bit of desperation.
80mins: Yellow card for Xhaka and Simons for di small fight.
79mins: SUBSTITUTION. Madueke enta for Simons, Teze enta for Branthwait while Til enta for Veerman.
75mins: Vieira rush shoot from long range and send am a little high over di bar.
73mins: SUBSTITUTION. Gabriel enta for Tierney. While Ben White enta for Tomiyasu
70mins: Cody Gakpo run too early into di Arsenal defence. Ref catch am offside.
68mins: Luuk de Jong almost score im second goal wit a header ey go wide.
67mins: Yellow card for Philipp Mwene PSV.
67mins: Yellow card for Gabriel Martinelli
64mins: SUBSTITUTION. Gabriel Jesus enta for Martinelli.
63mins: GOAL Gooal! Luuk de Jong make am 2-0 for PSV
62mins: Thomas Partey block counter attacj by PSV.
58mins: Tierney chop yellow card for foul on PSV player
57mins: SUBSTITUTION. Partey enta for Lokonga. Saka enta for Odegaard
55mins: GOAL. Veerman finally score for PSV.
51mins: Veerman attempts to score wit a first-time shot from di edge of di box. Ramsdale save am.
50mins: Xavi Simons shoot inside Arsenal penalty area but Aaron Ramsdale isave am.
49mins: Tierney sends weak shot high over di bar from di edge of di box.
47mins: Accurate pass to di edge of di box by Eddie Nketiah.
46mins: Martin Odegaard launch inaccurate corner kick into di penalty area.
45minss: SUBSTIUTION. Luuk de Jong enta for Anwar El-Ghaz
Second Half
Kick off: PSV 0-0 Arsenal

Wia dis foto come from, Getty Images
First Half: PSV 0-0 Arsenal
45+1mins: Odegaard produce good strike from di edge of di box.
Fine save by Walter Benitez.
41mins: Anoda disallowed goal afta Xavi simons goal.
39mins: Martinelli find im sef for better position inside box 18 but im finshing poor.
35mins: Good pass from Gutierezz to Gapko but Tomiyasu block am
33mins: Anoda offside for PSV. Di Gunners dey try keep Simons and Gapko offside sake of dia speed.
31mins: Sangare no dey give Odegaard chance for dat midfield.
30mins: Arsenal survive di pressue from PSV lead by Simons.
28mins: Nketiah header go wide. Good cross from Martinelli
26mins: OFFSIDE. PSV lose dia counter attack as linesamn catch El-Ghazi for offside
24mins: Corner for Arsenal. But easy catch for Benitez
22mins: Arsenal dey pass dia way around for di pitch. Currmtly wit 72% ball possession
20mins: Lokonga dey too forceful wit im tackle. Ref blow for freekick
19mins: DISALLOWED GOAL. Cody Gakpo score but referee blow for offside
17mins: Gabriel Martinelli (Arsenal) play powerful shot towards goal, but di defender block am.
15mins: Kieran Tierney gets into good position inside di box.
12mins: Ibrahim Sangare give away foul during attacking move and di referee blow im whistle.
11mins: Cody Gakpo commit rough challenge and Marco Di Bello blow for foul.
10mins: Sioms and Gapko one-two touch dey blocked by Holding.
9mins: Viera dey penetrate from di left but im pass neva click
8mins: Xavi Simons waste an opportunity
4mins: Arsenal dey try rush PSV but dia defese dey kampe
2mins: Cody Gakpo (PSV) swing cross into di box.
But t too close to Aaron Ramsdale wey handle di ball
1 min: Gae don start
Kick Off: PSV 0-0 Arsenal
PSV vs Arsenal head to head
PSV need to bounce back from dia back to back defeats to Arsenal and Groningen.
Di Ruud van Nistelrooy side no dey too strong as e don show for di outings.
Di club in-form foward, Cody Gakpo go wan prove im sef afta wetin happun for di last fixture for di Emirates Stadium.
Arsenal don already qualify for di knock out stage of di competition but dem go wan try avoid to meet any of di clubs wey just drop from di Uefa Champions league.
Mikel Arteta men dey go into dis fixture afta dia disappointing 1-1 draw wit Southampton ova di weekend.
"Last week we make di first step wey na to qualify for di next round. We need to win [on Thursday] becos we want finish first," e tok.
PSV vs Arsenal team news
Nistelrooy dey look to get boost for im squad wit di return of Noni Madueke, Luuk de Jong, and Mauro Junior.
However, Yorbe Vertessen, Marco van Ginkel, Ismael Saibari, Kjell Peersman and Olivier Boscagli still dey missing sake of injury.
For Arsenal Arteta tok say Marquinhos no follow di squad travel afta e fall ill in di build-up to di game while Oleksandr Zinchenko still dey struggling wit a calf injury.
Emile Smith Rowe and Mohamed Elneny still dey recover from dia groin and hamstring issues respectively.













