Journalist Edward Kijanangoma become new King of Tooro Kingdom afta succession wahala

Prince Edward Kijanangoma
Published
Read am in 5 mins

Dem don crown Edward Rukidi Kijanangoma king of Uganda Tooro kingdom.

For long, di new monarch na familiar face for di East African nation, but many pipo no sabi as heir to di throne, but as a storyteller, long-serving anchor and editor for di state broadcaster.

But di 56-year-old - now King Edward Rukidi Kijanangoma Nyabongo I - don bicom di subject of media attention imsef as im rise to di Tooro throne don spark controversy and widespread reactions beyond di kontri.

Tooro na one of Uganda four main officially recognised historical kingdoms. For di last 31 years, na King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV bin dey rule di kingdom. Late King Oyo at di time, bin dey known as a "boy king", afta e become king as baby.

President Museveni (left), restore di traditional kingdoms for di 1990s, dey pictured wit Tooro King Oyo (right) in 2010
Wetin we call dis foto, President Museveni and di late King Oyo for 2010

Dis position for new king bin open afta di Uganda President Yoweri Museveni say di King of Tooro, Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV wey die at di age of 34 on Thursday, 27 August die of cancer.

Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV bicom king of Tooro for western Uganda wen e just be three years old for 1995 afta di death of im papa.

Although na elected president and parliament dey rule Uganda, di kontri get plenty traditional kingdoms wey get significant cultural influence even though dem no get political power.

Oyo, wey Guinness World Records list as di world youngest reigning monarch, bin rule ova more dan two million pipo.

E be di 13th monarch of di kingdom wey dem establish for di early 19th Century.

Di crowd wey gada di Prince as e bin dey comot one palace go anoda

Who be di new Tooro King

New Tooro king Kijanangoma
Wetin we call dis foto, Kijanangoma bin work as journalist for most of im adult life

Kijanangoma and di late King Oyo na cousins. Both of dem na grandsons of Rukidi III, di 11th king, or Omukama, wey bin rule di Tooro kingdom from 1928 to 1965.

Kijanangoma dey among di several pipo dem consider for di role, including Prince George Desmond Kamurasi, wey dey play football for one of UK best-known amateur clubs.

According to di succession committee, di South East Dons captain and goalkeeper reject di offer of di throne, as e cite oda responsibilities.

Afta dem formally announce am, Kijanangoma promise say di palace go dey open to di pipo, as e vow to focus on unity and development.

"I ask you for one tin - dem don give me dis title as king but I no fit work alone, I gatz work wit you," e tok.

Dem born Kijanangoma for 1970 and e grow up for dia family house for Kidukuru village for Fort Portal, about 300km (186 miles) from Kampala.

E comot di village to pursue further studies and e graduate wit Mass Communication degree from Uganda Makerere University for 1999.

E work as broadcaster for career wey span more dan two decades, including for neighbouring Rwanda and for im kontri, Uganda Broadcasting Corporation (UBC).

Di years e spend for public, di interactions wit leaders plus di exposure to national affairs for im work as journalist fit serve am well as e return to di community e come from, dis time as dia leader.

Afta dem crown am king, Kijanangoma say im go use di connections e don build for ova 21 years working as journalist "to get good tins for our pipo".

Im mama, Assimwe Yusta Kijanangoma, dey confident say e dey well prepared for im new role. She say im upbringing dey deeply rooted in tradition.

"I really raise am wit di teachings of di old kingdom of a cane and instructions and scolding. I dey laugh wit am, and oda times I dey scold am," she tell BBC.

She add: "Eddy dey well-mannered, e no dey fight, or shout, even wen pipo offend am, e go just tok small."

She dey happy for her son, although she agree say she get mixed emotions, especially as her son dey take ova afta di death of a "great man".

Uganda traditional kings no get any formal political authority, but dem get cultural influence and dey command ogbonge loyalty for di communities dem dey lead.

Di kontri na home to four main kingdoms, di largest and most popular na Buganda for di central region, wey encompass di capital Kampala.

Dem cancel di kingdoms for 1967, but President Yoweri Museveni restore dem back for di early 1990s.

Di govment say na to promote cultural pride and national unity, but pipo interpret di move as way of appeasing communities and fostering political loyalty.

For di middle of di succession wahala, di govment bin support di Babiito clan choice of Kijanangoma.

Attorney General Sam Mayanja tok say di Tooro Kingdom get clearance to go ahead wit di coronation, as no formal complaint dey against am.

Na di govment plus President Museveni announce di date of di coronation wit di ceremony.

Di president son wey also be di head of di military, Muhoozi Kainerugaba, also publicly support Kijanangoma. "Long may e reign," e post on X.

Kijanangoma veri name point to im royal heritage.

Dem born im papa, di first Kijanangoma, di year King Rukidi III bicom king. Na di king give am di name, wey mean di "one wey come wit di royal drum".