You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
NDLEA bust anoda multi-billion naira meth lab for Nigeria, gbab Mexicans and Nigerians
Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don bust one multi-billion naira factory for deep inside one forest for Oyo State, southwest Nigeria, wia dem dey produce methamphetamine on large industrial scale.
Di anti-drug agency call am "massive factory-level production line of poison".
Methamphetamine na one lab-made (synthetic) stimulant wey dey veri addictive. E also dey known as "crystal meth," "Tina," or "ice." E dey make pipo high.
During one press conference for NDLEA headquarters on Wednesday, tok-tok of di agency pesin Femi Babafemi wey represent dia oga patapata Mohammed Marwa, tok say dia operatives bust one fortified, industrial-scale secret methamphetamine laboratory wey one Nigerian-Mexican cartel dey operate deep inside di forest of Tapa Village, Ibarapa North Local Govment Area of di state.
Babafemi say dis discovery lead to di arrest of one 56-year-old Mexican methamphetamine expert and four oda Nigerians.
"On Wednesday, 17th June 2026, tactical operatives of di NDLEA bin storm one highly fortified, industrial-scale clandestine methamphetamine laboratory wey dey operate deep within di forest of Tapa Village, Ibarapa North Local Govment Area, Oyo State."
Babafemi say dis development dey come barely four weeks afta di anti-drug agency bust one similar massive meth laboratory for inside one forest for Ijebu East, Ogun State, southwest Nigeria.
Babafemi say dis signal desperate attempt by drug barons to turn di southwest into synthetic drug manufacturing factory.
Wetin NDLEA recova
According to NDLEA, di laboratory dey fully stocked wit different kind of dangerous chemicals, industrial catalysts, and strong processing machines wey fit do heavy work.
Di chemicals and materials dem recova include;
- Phenyl-2-propanone (P2P) - wey be di main and highly controlled chemical wey dem need to take cook methamphetamine
- 1800-litre drums wey contain Phenylacetic acid - Dis na di main chemical dem dey use produce P2P
- Two 180-litre drums wey carry about 300 litres of white crystal-like substance
- Four 180-litre drums wey contain dark liquid wey still dey undergo processing
- 101 bags (25kg each) of Caustic Soda
- 17 containers (25L each) of Sulphuric Acid
- 19.5 containers (25kg each) of Tartaric Acid;
- 5 containers of Reniso Ultracool 68 (three 50L and two 25L capacity)
- 25 bottles (500ml each) of 80% Thioglycolic Acid
- 2 containers (25L each) of Ethyl Phenylacetate
- and 25 cartons of aluminium foil.
Di Industrial Processing Equipment dem discova for di site include:
- One (1) reactor pot wey be di heart of di chemical synthesis
- Two (2) mounted distillation units and three (3) fabricated mixers and condensers
- Two (2) vegetable dehydrator machines wey dem dey use quick dry di crystals
Di suspects
Di anti-drug agency say na on Wednesday, 17 June dia operatives bin storm one highly fortified, industrial-scale clandestine methamphetamine laboratory wey dey operate deep within di forest of Tapa Village, Ibarapa North Local Govment Area of Oyo State.
During di raid, dem arrest five key members of di cartel on-site wey include one 56-year-old Mexican methamphetamine expert, wey dey provide di technical expertise for large-scale synthesis.
Di oda four Nigerian suspects dey provide logistical support, cova, and local operations.
"Di arrest of one foreign cartel expert for inside Nigeria show say dis threat no dey only inside one kontri, e dey across borders. But more importantly, e show say our agency get top-class intelligence power to track, stop, and scata dia plans.
"Samples of di finished crystals dem record test positive for methamphetamine.
"Furthermore, di crystalline substance from di 180L drum test positive for Phenylacetic acid," Babafemi tok.
Di agency say dem don evacuate di exhibits, save and document dem for comprehensive and strict evidential presentation for court.
Wetin be methamphetamine
Methamphetamine or meth for short na one man-made veri addictive stimulant drug.
Na powder wey di user fit turn to pill or a shiny rock (wey dem dey call crystal).
Dem fit chew am as powder, inhale am, smoke or inject am for peisn vein.
Meth at first, go make user high and feel good, but den users go later begin feel edgy, overly excited, angry, or afraid.
Pipo wey dey abuse methamphetamines dey feel high and full of energy. Dem tink say di drug go allow dia bodi to continue dey work for long time. But meth dey damage di bodi and brain, especially wit repeated use.
Di side effects include rapid breathing, irregular heart rate, and increased blood pressure.
Users dey also complain of sweating, headaches, blurred vision, dry mouth, hot flashes, and dizziness.