How dem kill seven pipo during attack on US embassy convoy for Ogbaru

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria Police say joint security forces don rescue di remaining two victims wey jaguda pipo kidnap during di attack on one United States embassy convoy along Atani/Osamela road in Ogbaru Local Government Area (LGA) of Anambra State, south east Nigeria.
Di Police Command Public Relation Officer for Anambra state, Ikenga Tochukwu, for one statement say dem rescue di two pipo for early momo on Friday. None of dem injure.
Tochukwu add say dem still dey do operation for di area.
How 7 pipo for US embassy convoy die under curfew
Di attack on convoy wey carry US consulate inside Anambra State on Tuesday bin draw attention on di insecurity palava for di state in general and for Ogbaru Local Goment in particular.
According to Echeng E. Echeng, Anambra State Police Commissioner, seven pipo, including four police officers and 3 US consulate staff die wen for di attack. But dem no kill any US citizen.
Di police add say two of di consolate officials bin dey miss as di gunmen carry dem go.
Echeng blame di attack on members of di Eastern Security Network (ESN), di armed group of di proscribed Indigenous People of Biafra (Ipob).
Im reveal say security forces raid di ESN camp for Ugwuaneocha community for Ogbaru afta di attack but say dem no see anybody.
End of Di one wey oda users dey read well well
“We arrest two pipo wey help us wit investigations,” Echeng .
Di US consulate staff bin travel from Lagos to access di impact of erosion for di local goment becos e close to River Niger. Ogbaru na one of di areas for Nigeria wey dey suffer constant flooding.
How di attack happun
Dis attack on di US consulate convoy no be di first attack by unknown gunmen or pipo wey dem dey suspect to be Ipob.
Pascal Aniegbuna, wey be di local goment chairman of Ogbaru, tell BBC say pipo for di community tell am say dem notice presence of di assailants about two days to di attack.
According to Aniegbuna, di attack occur for road between two communities - Ogbakuba and Umunankwo.
“Di specific location na near Ofia Umuoga. Di convoy wey get two SUV vehicles wit police escorts, bin dey go Umunankwo,” he tok.
Im add say di gunmen shoot di pipo inside di car, kill some of dem, come set di car on fire wit di bodies inside.
Di bodies burn beyond recognition, Aniegbuna tell BBC.
“We alert di Naval commander witin di area and im sharply dispatch forces to di scene. Di gunmen run enta bush as dem see di security forces,” im tok.
Di commissioner tell BBC say di attack surprise am beocs e don tey wey dem experience dis kain incident for Ogbaru.
However, checks wey BBC show say di attack on di US Consulate staff na di second attack for Ogbaru LGA wey media don report for 2023.
Timeline of attacks
On 4 March 2023, dem kill one policeman for Atani axis of di LGA wen unknown gunmen attack one police checkpoint.
One attack for Atani Divisional Police Headquarters on 13 April 2022, lead to di killing of 4 police officers.
However, e get oda attacks and clashes between unknown gunmen and security agents going back to 2020.
On 29 June 2022, Nigeria security forces kill several pipo for Ogbaru. Dis killing lead to protests on social media wit di hashtag #OgbaruMassacre wey trend for days.
Nigeria security forces say dia hand no dey for di massacre, come add say di pipo wey ndo di killing dey for one camp inside one big forest wey stretch from Ogbaru to Ihiala.
On 25 May 2021, Nigerian Navy exchange gunfire wit gunmen for Ochuche community inside di local goment. Dem no kill anybody.
On di 16 day of 2022 Nigerian Navy kill one person and arrest four men wey dem bin members of Ipob for Uga Junction, Ogbaru LGA. Di navy officers recover two pistols and machetes from di men.
On December 31 2021 Nigerian Navy special forces raid one camp for “Ochan” Forest and kill 10 suspects and arrest 5. Ochan Forest dey for border between Ogbaru and Ihiala.
On November 15 2021, gunmen kidnap di traditional ruler of Ogwaniocha for Ogbaru LGA and burnt im house.
“We go bring di offenders to justice” Buhari
President Muhammadu Buhari express sadness about di attack, come say im goment remain “committed to fish out di offenders of di attacks and bring dem to justice”.
US Secretary of State, Anthony Blinken, for statement wey dem release om 18 May, say dem neva sabi wetin dey behind di attack.
“We no get idea at dis time say dem bin dey target against our mission,” im tok.
However, for anoda statement wey di Press Secretary, Christian Aburime sign, Anambra State goment suggest say di presence of di policemen fit bin attract di attack.
Ogbaru LGA na one of di 8 LGAs for Anambra State, wia goment bin impose curfew 25 May 2022. Oda affected local goment na Aguata, Ihiala, Ekwusigo, Nnewi North, Nnewi South, Orumba North and Orumba South.
Di goment say di curfew na sake of insecurity. Di curfew still dey in place.









