How Nigerian Navy catch 11 men wey hide inside ship to japa enta Ghana

Di eleven pipo wey hide inside ship

Wia dis foto come from, Nigerian Navy

Published

Authorities for Nigeria don catch eleven men wey hide inside ship in dia attempt to japa illegally go Ghana.

Nigerian Navy say dia Ship BEECROFT patrol team catch di stowaways aboard Gwangzhou Highway Panama ship enroute Ghana.

Base Information Officer of di Nigerian Navy Ship BEECROFT, Sub-Lieutenant H.A Collins tok dis one for statement wey e release on Thursday.

Oga Collins say na around 7pm Nigerian time on Tuesday wen di Navy Ship BEECROFT patrol team dey do dia work dem catch di men.

E say dem shaparly alert di Western Regional Control Centre (WRCC) to stop di vessel inside di Lagos anchorage.

“Initially we arrest four stowaways from di stern of di vessel.

However, di four pipo wey we arrest come reveal say more pipo dey hide inside di ship.

Following a comprehensive search, we discover seven more stowaways inside di ship, wey bring di total to 11 stowaways wey we pull out of di vessel and keep dem for custody,” Collins tok for di statement .

Gwangzhou Highway Panama ship

Wia dis foto come from, MarineTrafic.com

Di men wey wan japa illegally dey between di age of 19 and 37 years – dem from different parts of Nigeria.

E no clear how dem take reach di ship to fit hide inside.

Tori be say di men no even sabi wia di ship dey go – but di Nigerian Navy say confam say na Ghana.

“Apart from say di stowaways put demselves in life threatening situations during di long voyage at sea, dem also show di kain security situation wey dey.

“Accordingly, dis arrest and handover by di patrol team na essential reminder of di critical role wey di Nigerian Navy dey play in ensuring maritime security,” e add.

Di Base tok-tok pesin say dem don handover di pipo give di Nigeria Immigration Service (NIS) in line wit di established protocols.

Oda times stowaways don hide for ships and planes

On different occasions, authorities for Nigeria and outside Nigeria don catch such pipo wey dem dey call stowaways.

For July 2023, authorities catch four men wey hide for di rudder of ship from Nigeria to reach di shores of Brazil 13 days later.

Na di crew members of anoda ship wey dey pass near di vessel for di Bay of Vitoria, Espírito Santo, inside southeastern Brazil discover di stowaways.

For February 2022, di Nigerian Navy arrest and hand over to di Nigerian Immigration Service six suspected stowaways - Pipo wey sneak enta one ship wey bin dey go Brazil.

According to statement from di Nigerian Navy Ship NNS Pathfinder wey Lieutenant Commander A. N. Ajah sign, na on 19 February 2022 Navy personnel wey bin dey MV African Runner receive call from a private Maritime logistics support company vessel MV ERA S say six stowaways gain access to di ship through di propeller area of di vessel.

For December 2021, Nigerian Navy Ship (BEECROFT) arrest five stowaways dem catch onboard MT CHEMSTRANS BALTIC vessel for Lagos anchorage. Commander NNS BEECROFT, Bashir Mohammed, for statement say dem arrest di stowaways on 30 November and hand dem over to di Nigerian Immigration Service.

Dia findings dat time as dem question dem reveal say di MT CHEMSTRANS BALTIC bin dey travel to Europe and di suspects gain illegal access to di ship, but di crew catch dem come hand dem over to NNS BEECROFT patrol team during routine Harbour patrol.

For 2013, one 13-year-old boy bin hide for di tyre compartment of aeroplane wey dey travel go Lagos from Benin City, Edo state and dem no discover am until di plane land for Lagos.

Di boy bin tink say di plane dey travel abroad but na Lagos e bin dey go. Im say na di poor situation for im family make am want to travel abroad to help im family.

For April 2021, Dutch authorities investigate di death of one man wey dem find im deadibody for di wheel arch of aeroplane wey come from Nigeria, as dem suspect say im be stowaway wey hide dia to travel.

Tok-tok pesin for di Royal Netherlands Marechaussee say di man fit don die from hypothermia due to di extreme temperatures wey di plane bin dey fly during di six hours, 45 minutes journey from Lagos to di Netherlands.

According to UN Refugee Agency guidelines, “Stowaway asylum-seekers must dey protected against by-force return to dia kontri of origin as dem dey particularly vulnerable situation wey need international protection and solutions wey go last."