Ghana govment re-introduce toll collection on new roads

Ghana dey experience rising living costs

Wia dis foto come from, Getty Images

Published

Ghana govment dey re-introduce road tolls on new roads wey dem dey build.

Dis be part of strategy to raise money to cover de construction of new roads through Private Public Partnership Agreement under de Ghana Investment Infrastructure Fund (GIIF).

Finance Minister, Ken Ofori Atta make dis revelation during de 2022 mid year budget review for parliament today.

“Govment of Ghana go provide funding through GIIF... We go toll de completed road to recover de whole life cost of de completed infrastructure” Ken Ofori Atta reveal.

De Finance Minister add say roads like de 22.7 kilometer Accra-Tema Motorway extension project go be one of de roads dem go re-introduce toll collection on.

Last year govment cancel de collection of road tolls across de country during de 2022 Budget Statement.

One year on dis re-introduction according to govment go ensure say road users pay for de cost of news roads wey dem build though private public partnership.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Inflation hit 29.8% for Ghana outlook

Ghanaians cedi dey depreciate against de US dollar

Wia dis foto come from, Getty Images

Inflation rate for Ghana rise catch 29.8%, de highest since 2003 wen Ghana declare itself Highly Indebted Poor Country (HIPC) 19 years ago. 

Cost of living continue to rise as citizens continue to spend more money for less goods. 

Rising cost of living push inflation go 19.4% as of March 2022, by May inflation jump catch 27.6% and de latest inflation rate in June be 29.8% according to de Ghana Statistical Service.

Dis be de 13th consecutive month inflation dey rise for Ghana resulting in two-day demonstration for de capital, Accra. 

Pipo dey spend more on food, housing, fuel/transport, utilities (water/electricity/gas) den stuff.

Cost of Transport be one of de major drivers of inflation for de kontri, commuters dey pay 41.6% more.

Meanwhile, housing which dey include water, electricity den gas hit 38.4% inflation wey food prices rice by 30.7%. 

Ghana go IMF for bailout

De International Monetary Fund (IMF) say dem make ready to support Ghana with financial bailout.

Dis be afta week long meeting with Ghana govment afta President Akufo-Addo invite dem to help de country address de growing economic challenges.

IMF team finish dia meetings with in Ghana yesteon positive note with promise say dem go support de country with bail out.

De IMF delegation to Ghana wey Carlo Sdralevich lead between July 6-13, 2022 assess de economic situation in de country plus de Enhanced Domestic Program of govment dem want make IMF support.

Dem meet wit de Vice President Mahamudu Bawumia, Finance Minister Ken Ofori-Atta, Govnor of Bank of Ghana, finance committee for parliament, CSOs den oda development partners and agencies.