Why Actors Guild of Nigeria suspend actress Halima Abubakar

Wia dis foto come from, @halimabubakar/Instagram
Di Actors Guild of Nigeria (AGN) don suspend Nollywood actress Halima Abubakar until further notice.
AGN wey be di join-bodi of actors for di kontri for one statement say dia reason na sake of di report of di investigation wey dem conduct on di actress.
Dem say dia decision dey come "afta di thorough investigative report by di special Secret Investigation Panel wey dem set up to conduct internal underground secret investigation into di activities of some blog/bloggers".
"Afta two years of painstaking investigations, di Panel find out say Miss Halima Abubakar bin dey behind all di slandering information of our members, associates and patrons, especially news of extra marital affairs linked wit highly placed individual for di society wey dey come from di industry," di statement tok.
Miss Abubakar neva react to dis allegations and BBC News Pidgin dey try get di actress to react to am.
Dem say Miss Abubakar go dey on indefinite suspension from di AGN and face di National Disciplinary Committee to determine her full punishment.
AGN say during dis suspension, she no dey permitted to participate for any AGN or filming activities.
"Di National/State Chapter Taskforce don dey duly mandated to monitor di compliance of di above order as violations of di suspension rules fit lead to further disciplinary actions.
On behalf of di Actors Guild of Nigeria, I commend di professional and incisive work wey members of di secret investigative panel do," AGN tok.
AGN say di secret panel dey investigate some female members wey dey on di watch-list, "especially for di recent release of names purported to get dealings wit di Senate President".
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
E neva clear how di suspension go take affect Halima career.
Although di AGN get plenty members, no be all actors be members of di association ad dia actions no fit stop independent movie producers wey choose to feature Halima for dia movies.
Who be Halima Abubakar?
Ms Abubakar na Nigerian actress. She don feature for many feems and according to wetin she write on her Instagram account, she don collect plenty awards.
Also her Instagram handle describe her as Peace Ambassador for di United Nations, however BBC neva fit verify am.
For 2022, Ms Abubakar bin make headlines afta she accuse di Senior Pastor and General Overseer of Omega Fire Ministries International, Johnson Suleman of heartbreak. She say e fail on im promise to marry her.
At di time, she bin also allege say di cleric inflict her wit one life-threatening sickness, one health condition she bin claim say torment her for years.
All dis dey come afta she disclose say she bin get affairs wit di man of God.
Di allegations bin escalate wen Pastor Suleman for January 2023, file 1 billion naira defamation lawsuit against di actress, as e insist say wetin she tok na lie and she wan spoil im reputation.
For April 2024, one High Court for Abuja bin fine di actress 10 million naira as damages for defaming Apostle Johnson Suleman of Omega Fire Ministries International.
In addition to di financial penalty, di court bin also rule say make Ms Abubakar withdraw all di defamatory statements on her Instagram account.
Di court also add say make she comot all di links and reports wey contain di said comments from various internet platforms.









