Nigerian 'chess master' conclude campaign to set new Guinness World Record by playing for 58 hours straight

Tunde Onakoya dey play chess for Time square New York

Wia dis foto come from, Tunde Onakoya

Wetin we call dis foto, Tunde Onakoya dey aim to break GWR wit chess game of 58 hours without defeat
Published

Ogbonge Nigerian chess player Tunde Onakoya don conclude im attempt to set a new world record by playing for 58 hours straight.

He do am to di sound of claps and cheers of di pipo wey bin don gada to watch am carry out dis ogbonge tin.

Na on di 17 Onakoya bin post for im social media handle say im go attempt to break di Guinness World record for di longest Chess marathon for di heart of Times Square New York City for 58 hours without losing one game.

Onakoya for di post say im dey do dis for di dreams of millions of pikin dem across Africa wey no get access to education.

Im dey try raise $1 million to support global chess education for pikin dem.

“You guys don dey rock solid for me through di years, so I need all of us to come togeda now more dan ever to show di world say di Nigerian spirit dey strong and we fit do great tins from one small place against all odds,” E continue for di post.

Tunde Onakoya no be small pikin for chess game, e dey popular for Africa and obodo oyinbo.

So many Nigerians including former vice presidents, Atiku Abubakar, Professor Yemi Osinbajo, Ogbonge banker Tony Elumelu, Lagos state Govnor, Babajide Sanwoolu and odas don tok say dem tanda gidigba behind am.

Di marathon bin start on Wednesday, 17 April end on 19 April for America time.

As at di time e reach 17 hours wen e bin don dey play, over $22,000 dollars don enta di donation wallet wey im organisers set.

Who be Tunde Onakoya?

Tunde Onakoya

Wia dis foto come from, Tunde Onakoya

Tunde Onakoya na di founder of Chess in slums Africa.

E bin no too get advantage of plenti tins wen e dey grow up but later discover di game of chess as one way to comot for im poor background.

Dat na why Oga Tunde set up Chess for Slums for 2018. Im reason for dat na say every pikin deserve one equal opportunity to get beta life.

For one book about Chess for school wey Bloomsbury bin publish for 2019, Oga Tunde tok say:

Di believe na wetin make am to adopt one new way wia dem go use chess to empower pikin dem wey come from poor background to learn academic, educational and critical thinking skills wey go helep dem gbab beta tomorrow.

E further tok say some oda organisations like im own dey across Africa wey commit demselves to bring chess to pikin dem wey dey disadvantaged.

“No be only my life wey chess transform, I dey grateful say I, in turn dey able to play one small part to transform oda lives.”

“Pikin dem dey every school, both primary and secondary, wey dia lives go transform if you introduce dem to chess for di right way and di right time, e tok.

Tunde Onakoya don helep plenti pikin get beta life wit chess, one of di tori wey stand out na dat of Fawaz Adeoye wey be former bus conductor for Lagos wey become chess champion.

Fawaz Adeoye become di best player for one Lagos tournament even though e dey live under bridge.