Slovak PM no longer dey 'life-threatening' condition afta shooting
Slovak Prime Minister Robert Fico dey for stable but serious condition afta pesin shoot am many times on Wednesday, doctors don tok.
Deputy Prime Minister Robert Kalinak add say oga Fico wounds dey "complicated".
Oga Kalinak wey also be di defence minister say, "for night, di doctors bin manage to stabilise di patient condition. But di condition still dey very serous as di injuries dey complicated."
Anoda Deputy Prime Minster, Tomas Taraba bin tell BBC say oga Fico surgery bin go "well" and "I guess say at di end e go survive."
Interior Minister Matus Sutaj Estoka say na politically motivated assassination attack.
Even though oga Fico na pesin wey dey divisive for im kontri, and dey cause kasala for EU, sake of say im want make dem stop military aid to Ukraine and di sanctions on Russia, but dem don condemn di attack from both far and wide say na attack of democracy.
Dem shoot Oga Fico as im bin dey greet crowd of pipo in front of one cultural community centre for one town wey dey for Handlova, one goment meeting bin dey happun for dia, na so di tori tok.
According to journalists wey bin dey dia wen e happun, dem say dem hear several shots.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Slovak leader dey hospital and police say dem don detain di alleged attacker.
Handlova dey around 180km (112 miles) north-east of di capital Bratislava.
One witness bin tell di Dennik N website say she hear three or four shots and see Oga Fico fall for ground. She see wounds for im head and chest.
Im security pipo bin bundle am enta car, and local reports say dem carry am by helicopter to one nearby hospital.
One video show plenty men wey bin dey rush to detain di suspect just outside di cultural centre for Handlova. BBC no fit verify di footage yet.
Police neva tok who di alleged suspect wey dem arrest be but tori be say, na one 71 year old writer and political activist.
Di shooting dey come one day afta parliament start to dey discuss goment proposal to ban di Slovakia public broadcaster, RTVS.
Thousands of Slovaks bin don protest against di planned reforms of di public broadcaster in recent weeks.
But dem cancel one planned opposition-led protest wey suppose happun on Wednesday afta di shooting.
For im interview wit BBC, Deputy Prime Minister, Taraba bin blame wetin e call "false narratives" by opposition parties for di kontri for di shooting.
E tell BBC World Tonight say, "our prime minister don tok plenti times say e fear say sometin like dis go happun."
Taraba say, oga Fico don warn say di way "di goment bin dey attacked by false narratives fit overheat pipo reaction and cause sometin like dis."
And Interior Minister Estok follow blame tori pipo for wetin happun as e tell dem for press conference say, "many of una na im dey sow dis hatred."

Wia dis foto come from, Reuters
Slovakia outgoing President Zuzana Caputova react to di shooting say she dey shocked by di "brutal and ruthless" attack on di prime minister, she add say she wish am strength to recover.
Oga Fico return to power for Slovakia afta last September elections, as di head of one populist-nationalist coalition.
Im first few months as prime minister get as e be. For January, im stop military aid to Ukraine and last month, push through plans to ban public broadcaster RTVS.
World leaders condemn shooting of Slovak PM
European Commission President Ursula von der Leyen condemn wetin she call "vile attack" on Fico.
Romanian Prime Minister Marcel Ciolacu say im "shock well-well" by di tori of di shooting, and add say dem must hold di jaguda pipo accountable.
Czech Prime Minister Petr Fiala say di shooting dey "shocking" e wish Fico quick recovery.
Hungary Prime Minister Viktor Orabn say im dey "deeply shocked by di terrible attack against my friend, Prime Minister Robert Fico".
Who be Robert Fico?

Wia dis foto come from, Reuters
Slovak Prime Minister Robert Fico return to power afta elections last September, as di head of one populist-nationalist coalition.
Na im dey lead di populist left-wing Smer-SSD party and win di vote last October wia im pledge to stop military aid to Ukraine, but im deny say im be pro-Russian.
Fico bin dey forced to step down as prime minister sake of di murder of investigative journalist Jan Kuciak for 2018.
"If Smer enta goment, we go send one single round of ammunition to Ukraine," Fico tell supporters during im campaign.
Dis, as well as im pledge to resist Western sanctions on Russia, cause some pipo to compare Fico to popular Hungary right-wing Prime Minister Viktor Orban.
Slovak PM shooting: Wetin we know so far
Details still dey come out about di incident for Slovakia, wey involve Prime Minister Robert Fico afta dem shoot a couple of times dis afternoon. Dis na wetin we know so far:
Dem shoot am and im wound wen im bin dey leave one goment meeting for di central town of Handlova
Officials bi first say im condition dey 'life-threatening' before dem late give update say e no longer dey life threatening. Dem add say im dey receive treatment for hospital
As Fico bin dey greet crowd of pipo in front of one cultural community centre wia goment meeting bin hold, dem hear several shots before im security detail bundle am put inside one nearby car
Local reports say dem shoot Fico for im belle, arm, and leg. Pictures show as police detain one suspect
Dem carry am for helicopter to one nearby hospital before dem later fly am to anoda hospital for Banska Bystrica, east of Handlova, reports say














