All you need sabi about Charlie Kirk memorial service wia Trump and oda US officials go speak

Wia dis foto come from, Anna Moneymaker/Getty Images
Memorial Service for conservative activist Charlie Kirk go hold on Sunday, 21 September for Arizona, afta dem shoot and kill am earlier dis month for Utah University during one event.
Di popular figure for America right-wing political sphere, Kirk death bin create widespread reaction from di current administration.
President Donald Trump say im dey "filled wit grief and anger", while Vice-President JD Vance follow Kirk casket from Salt Lake City, Utah to Phoenix, Arizona.
Oga Trump plus oda prominent American political figures go attend and tok for di memorial of di 31-year-old conservative activist wey dey die two weeks ago.
Key informate about di memorial service

Wia dis foto come from, Getty Images
Di doors of di venue for di memorial service dey expected to open at 08:00 local time (16:00 BST).
Di programme dey expected to start at 11:00 local time.
Dem go hold di memorial for di house of American football league NFL Arizona Cardinals for State Farm Stadium for Glendale, Arizona. Di place fit sit more dan 63,000 pipo – and e fit expand for up to 73,000 for major events like today own.
Ova 100,000 pipo dey expected to attend di event wey Turning Point USA (TPUSA), dey organise.
Heightened security dey expected, including "TSA-level screening", according to TPUSA.
One senior Department of Homeland Security official tell CBS say di memorial service get di same security designation as high-profile events like di Super Bowl.
Di organisation tok say dose wey go pay tribute to Kirk on stage go include im wife, Erika, plus members of di Trump administration, wey include US President Donald Trump and Vice-President JD Vance.
Dem don inform guest to register wit Turning Point USA, as attendance go be on a first come, first served basis.
For pipo wey no go fit attend in pesin, di memorial go dey live-streamed via Kirk social media account.
Meanwhile, plenty crowds don begin gada for di event. BBC report say thousands of pipo wey dey go di stadium dey stuck for inside traffic.
Many pipo dey jump out of cars and dey waka go di venue.
As part of Kirk memorial service, organisers don ask attendees to wear red, white or blue - wey reflect di colours of di American flag.
Security dey veri high for di venue, as dem reason say more dan 100,000 pipo dey likely to attend di event.
Full list of speakers

Wia dis foto come from, Reuters
US President Donald Trump dey among dose wey go tok for di memorial service. Here na di full list of speakers wey dem announce for di Kirk memorial website:
- Charlie Kirk wife, Erika Kirk
- President Donald Trump
- Vice-President JD Vance
- White House Chief of Staff Susie Wiles
- Secretary of State Marco Rubio
- Health Secretary Robert F Kennedy Jr
- Secretary of War Pete Hegseth
- Director of National Intelligence Tulsi Gabbard
- Former Fox News host Tucker Carlson
- White House Deputy Chief of Staff Stephen Miller
- Director of di White House Presidential Personnel Office Sergio Gor
In addition to dose above, di website say dem go announce more names.

Wia dis foto come from, Reuters
Dem shoot Charlie Kirk, wey co-found Turning Point USA wen e be 18-years old, for one speaking event for di campus of Utah Valley University on 10 September. Dis don reignite concerns about political violence for di US.
A polarising figure, different perspectives about im legacy and possible motives for di shooting don create deep divisions for America.
Public shootings for US dey normally met wit calls from political leaders for calm, prayer and unity.
But di Trump administration dey try blame and crack down on di "radical left", wey in turn don lead to accusations of govment overreach and claims say dem dey use Kirk death as pretext to intrude on civil liberties.
Tensions still dey high following di killing of Kirk.
Many tins still dey unknown about di suspected shooter motive.
Utah govnor tok say 22-year-old Tyler Robinson, wey dey charged for di shooting and wey still dey for prison get "leftist ideology". Officials say dem see shell casings wit anti-fascist slogans.
But wetin dem mean exactly and oda messages still neva dey clear.









