'We reject illegal migration'- South African president Ramaphosa address nation ova protest against foreign nationals

Wia dis foto come from, Frennie Shivambu/Gallo Images via Getty Images)
South African President Cyril Ramaphosa don address di nation wia e torchlight say di kontri no go gree for illegal migration afta series of protests against foreign nationals.
Ramaphosa give di nation address as part of im govment approach to address illegal migration and di recent rise in protests against foreign nationals for South Africa.
During di live address on Sunday 7 June, 2026, Ramaphosa say di kontri dey roll out different measures to curb illegal migration into South Africa.
"We must end illegal migration, we must deal wit di challenges. We reject di notion say we must tolerate illegal migration. We fit enforce our laws, we fit secure our communities. We fit overcome di problem of illegal migration."
Ramaphosa address dey come as response to di series of attacks and protests against foreigners wey dey live for South Africa.
Some of di foreigners face serious harassment as some group of South African wey claim say di foreign nationals dey undocumented, give 30 June, 2026 as deadline for illegal migrants to comot for di kontri.
Dem claim say di foreign nationals dey take dia jobs.
Although, Ramaohosa say make South Africans 'no turn against foreign nationals and against each oda, as dem go gatz 'overcome di challenges through peace and love, not through fear, anger or violence.
End of Di one wey oda users dey read well well
For April 2026, wen di attacks dey go on, President Ramaphosa bin condemn di xenophobic attacks, wey see some South Africans attack black Africans and destroy dia businesses for di kontri.
Di South African leader during di 2026 National Freedom Day celebration wey hold for Bloemfontein on Monday, 27 April, say make im kontri pipo no allow dia legitimate concerns about illegal migration lead to hatreds towards fellow Africans.
E say although South Africans dey concerned about undocumented and illegal migrants for di kontri, but make dem no allow dis concerns lead to xenophobia.
Highlights of wetin president Ramaphosa tok for im address
'Illegal migration no be di cause of all our economic challenges'
President Ramaphosa say South Africa dey face serious challenges, but no be illegal migration cause am.
E say plenti families for di kontri dey face poverty and dey struggle to make ends meet, and di govment dey work on dose issues.
"We know say migration na global issue, e dey affect many kontris around di world, our kontri like many odas throughout history na product of migration.
"Yet we must recognise say illegal immigration no be di cause of all our economic challenges."
Ramaphosa say di ansa to some of di problems for South Africa na faster economic growth, greater investment, industrial expansion, infrastructure development and di creation of millions of new jobs.
Although e stand gidigba say 'di responsibility to enforce immigration laws dey for di kontri hand and di kontri alone', but e no mean say make some pipo dey take advantage of am.
Ontop employment matter, Ramaphosa say di kontri get high level of young pipo wey no get job and dem dey struggle.
E say some of dis issues fit make some of dem direct dia frustrations 'to di pipo wey dey perceived as competitors for jobs and resources.'
'We get laws for South Africa' - Ramaphosa
President Ramaphosa say South Africa get laws, and anyone wey wan enta di kontri gat obey dose laws.
"We accept pipo from oda kontri wey enta our kontri. Like oda kontri, we get law on who fit enta our kontri, wetin dem fit do and which kain work dem fit do."
E add say any foreigner wey wan work for South Africa must get permit, including business owners.
"Evri pesin wey dey work for our kontri gatz dey legally permitted, if na business, you must dey permitted but di problem be say some pipo enta di kontri illegally.
Ramaphosa mention say di problem wey di kontri dey face na migrants wey enta di kontri illegally and dem no dey documented.
Di president acknowledge say truly some gaps dey for di South African system including unemployment, poor border system and migration issues.
E say South Africans get right to demand for better welfare and better life and im govmet go take measures to correct am.
"Gaps dey for our systems, South Africans dey entitled to expect better and we dey take corrective measures to solve am. Govment go take actions to address violation of immigration laws."
'South African no dey xenophobic' - Ramaphosa
Ontop accuse say xenophobic attacks dey go on for South Africa, president Ramaphosa say no be so, say e reject dat allegation.
For im address, e say South African no dey xenophobic and make di pipo no allow some bad groups to take advantage of di situation of di kontri.
"South Africa no dey xenophobic, as South Africans no dey xenophobic and we no be racist. Make we no allow groups to use di situation do lawless tins."
Ramaphosa say im no go fall for social media campaigns wey dey spread threats.
E say any foreign nationals wey wan live for South Africa must respect dia laws and policies, while dem go also strengthen dia immigration laws.
"Illegal migration na serious threat to security and stability for South Africa. We know say illegal migration dey stop our efforts to create decent jobs for our pipo."
Ramaphosa say part of di problem be say some employers dey employ illegal migrants becos dem fit pay dem small money to exploit dem.
E say im govment go now strengthen immigration laws and policies. as dem go also 'engage sister kontris to further strengthen collaborations' for issues of migration.
Measures to address illegal migration for South Africa
During im nation address, Ramaphosa roll out some measures wey di kontri go take to address illegal migration into di kontri.
Ramaphosa say dem go secure dia borders as 'secured border no be hostilty to oda kontris.'
E say di measures we e set na to address di loopholes wey undocumented migrants dey take advantage of.
Dis na some of di measures wey Ramaphosa say South Africa go embark on to address migration for di kontri:
- Di first one na to crackdown on illegal workers, we go deport illegal migrants wey dey live for South Africa.
- We go setup courts to deal wit deportation, Home Affairs go increase inspections to target employers wey dey give work to illegal migrants.
- We go increase penalties for employers wey employ undocumented illegal migrant, wit jail term.
- We go strenghten our immigration system wit technology, illegal immigration dey supported by corruption by public office holders and dose wey dey responsible go face di law.
- Extend biometrics for international airports and oda busy ports
- We go establish register wit digital registration. We go discontinue di green ID book regsiter, wey pipo dey use do identity theft.
- We go issue new registration for transportation and end abuse traffic registration number
- I go send envoys to sister kontris to tok on di issues we raise, and deal wit issues of migration.
"We go work wit oda kontris to work togeda to address issue of migration. South Africa not fit address migration alone."
"South Africa future dey inseparable from our African continent and migration pressure no fit dey achieved wit violence."
According to Ramaphosa, e say im wan build South Africa as kontri wey go dey free to trade but dem go tackle di issue of illegal migration and no go allow anybodi exploit dia problems.
"Law enforcement agencies dey ready to act to maintain law and order and safeguard public properties."
Ramaphosa say dis new measures and regulations go allow di kontri attract global talents and investments.
"Our pipo also travel abroad to learn and study, migration na way of di world, embrace am. South Africa na better kontri for migration.












