Who dey out and who dey in for President Nana Akufo-Addo cabinet shake-up

Published

Ghana President Nana Akufo-Addo don relieve finance minister Ken Ofori-Atta of im post in a fresh cabinet reshuffle afta plenti pressure from di citizens and lawmakers.

Last year, lawmakers for di governing party call on di president to sack di finance minister sake of im neva manage di kontri well, wia im take Ghana back to di IMF for bailout.

Di kontri under Ken Ofori-Atta don dey suffer economic crisis, wia cost of living don rise, wia businesses dey collapse.

Di president at di time tok say make di minister finish di IMF negotiation before anything.

Las-las di kontri get di $3bn IMF facility wia dem already disburse $1.2bn to di bank of Ghana account.

Di minister don supervise implementation of some of di unpopular taxes and policies for di kontri like di controversial electronic transaction levy (e-levy), Covid 19 levy wia dem still dey charge two years afta di pandemic and odas.

Goment also wan introduce anoda 15% VAT on electricity consumption for di kontri.

Afta widespread public backlash and threat by organized Labour to go on strike if dem pass di VAT, di goment suspend am.

Mohammed Amin Adam don replace di finance minister.

Before dis change, Mohammed Amin Adam be minister of state for di finance ministry.

Di latest reshuffle also don affect di health minister, Kwaku Agyemang Manu and di minister for roads, Kwasi Amoako-Atta.

Many pipo don tok say di health minister don supervise plenti shady deals for di Covid 19 vaccine acquisition wia parliament committee don find say no be appropriate.

For one parliamentary committee hearing, di minister Kwaku Agyemang Manu admit say, “im take some decisions to acquire di Covid vaccines without parliament approval.”

E don comot also say some of di suppliers neva deliver some of di vaccines wia di kontri pay for at di time.

Afta di ministers apologie for di committee, many pipo tok say di president for sack am for 2021.

Well, over two years afta, di president don sack am.

Di new minister for di sector na di oga for di kontri national health insurance authority, Dr. Bernard Oko Boye.

For one statement wia tok-tok pesin for di presidency don release, e explain say di shakeup dey take “immediate effect.”

Information minister Kojo Oppong Nkrumah dey go ministry of housing, wia im deputy Fatima Abubakar don chop promotion as substantive minister.

Di latest reshuffle don affect at least 13 ministers, 10 be cabinet ministers wia two be regional ministers.

Di oda ministers wey get new portfolio be Francis Asenso Boakye wia formerly e be works and housing minister.

Im now be minister for roads and highways.

Former greater Accra Regional Minister, Henry Quartey now be Interior Minister, wia di former interior minister now be minister of state for di presidency.

Titus Glover now be greater Accra regional minister, wia Lydia Alhassan be new minister for sanitation.

Dakoa Newman now be minister for gender, children and social protection.

Dis be im first ministerial appointment.

Di new minister for environment na Ophelia Mensah Hayford.

Andrew Egyapa Mercer be di new minister for tourism, culture and creative arts.

Deputy minister for local goment, Martin Agyei Mensah Korsah now be substantive minister for local goment.