Borno state goment and UNDP handover resettlement community wey dem rebuild

Wia dis foto come from, @GovBorno
Borno state goment and UNDP Nigeria handover community wey dem rebuild
Borno state goment in collabo wit United Nations Development Programme for Nigeria, don officially open 804 houses wey dem build to resettle pipo of Ngarannam community.
President Muhammadu Buhari chief of staff, Ibrahim Gambari, na im commission di resettlement for di IDPs on Saturday 22 October.
Out of di 804 houses, di governor for statement say na 564 dem don complete for now.
Zulum say goment dey build 304 houses while di UNDP dey build 500.
Govnor Babagana Zulum handover di 360 houses to di community, including marketplace and school, house for teachers and security forces plus one police station.
Di house owners also gifts of 2.674 cows, cloths, food amd N100 for each house owner.
Di EU bin also participate for di project through im support to di Regional Stabilisation Facility.
End of Di one wey oda users dey read well well
For July 2019, UNDP bin develop di di Regional Stabilisation Facility wit di support Sweden, di Netherlands, Germany, di United Kingdom and European Union.

Wia dis foto come from, @EUinNigeria
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3
Plenty communities for di state dey displaced for years now sake of di Boko Haram insurgency.
Di jihadists attack and destroy Ngarannam community for Mafa, some years back.
Most dis internally displaced pipo dey don dey live for IDP camps for years, but bin dey worry to go back home to dia communities.
But dis request bin dey difficult for goment to fulfil becos in addition to security issues, di insurgents bin burn many communities to ashes, so di pipo no get anytin to go back to.