Wetin we know about how President Tinubu do U-turn for appointment of NTA top oga dem

Wia dis foto come from, NTA
Ogbonge drama dey play out for di Nigerian Television Authority (NTA), wey be di official media organisation of di federal govment of Nigeria.
Dis drama na sake of di U-turn wey President Bola Tinubu do for di appointment of new oga patapata of NTA, just days afta di presidency bin make di announcement.
On August 20, di presidency bin announce say Tinubu don approve di appointment of Rotimi Pedro from Lagos State as di new Director-General of NTA, to replace Salihu Abdullahi Dembos.
Di announcement also tok say Tinubu appoint Karimah Bello from Katsina State as di executive director of marketing, Stella Din from Plateau State as executive director of news, and Sophia Mohammed from Adamawa State as managing director of NTA Enterprises Limited.
Di new DG don even resume duty for di NTA headquarters for Abuja, and even hold meetings wit some of di labour unions like di Nigerian Union of Journalists (NUJ) and di Radio, Television and Theatre Workers Union (RATTAWU).
However, on Tuesday, anoda announcement come out from di Presidency wey tok say Tinubu don comot Rotimi Pedro and recall di former NTA DG wey be Salihu Dembos and di former ED News Ayo Adewuyi.
Bayo Onanuga, one of di tok-tok pesins for Presido Tinubu wey release di statement, no give details of why dem make di U-turn. E only say Dembos come bak to complete im three-year tenure sake of say im initial appointment na for 2023.
Onanuga also say Adewuyi go complete im tenure wey go expire by 2027.
Similar situation bin also happen for August wen di Presidency announce di reappointment of Muheeba Dankaka as di chairperson of di Federal Character Commission (FCC) for anoda five-year tenure, but e no reach 24 hours, anoda announcement come out say Tinubu don comot Dankaka from office and appoint Ayo Hulayat Omidiran, wey be former lawmaker, as her replacement.
Di development cause serious confusion sotey di Emir of Ilorin, Ibrahim Sulu-Gambari, bin put out public statement to congratulate Ms Dankaka - wey be indigene of Ilorin - and also tank Presido Tinubu for di reappointment, but e no know say di presidency don reverse di appointment.
Since taking power for 2023, di Tinubu administration don face several embarrassing situations like dis wia dem go announce appointments and reverse am later or dem go announce appointments wey di appointees go just bone dem and abandon di position.
One example na wen Tinubu include di name of former govnor of Kaduna State, Nasir El-Rufai for im ministerial nominees, but El-Rufai no show up for di Senate screening as e tok say e no dey interested to be minister.
Anoda one na for di appointment of board members for di Central Bank of Nigeria (CBN) wia two nominees back to back fail to take up di appointment.
Presido Tinubu bin first appoint Urum Kalu-Eke, one former oga for World Bank, to represent di southeast region of di kontri for di board according to wetin di CBN Act tok, but e reject di appointment.
According to di lawmakers wey suppose screen di nominees, Urum Kalu-Eke no even bother to attend di screening process and e no send any letter.
Den Tinubu appoint anoda pesin, a lady wey her name na Ruby Onwudiwe, but e later withdraw her name sake of say she bin openly support di presidential candidate of di Labour Party - Mr Peter Obi - during di 2023 general elections.
How Nigerians react
Nigerians for social media chook mouth for di matter differently. While some pipo say di constant reversal for govment appoint dey embarrassing, odas say e show say di administration no dey shame to correct dia mistake.
One X user, Joseph Shoremekun say "di govment need to dey more coordinated and no dey do tins wey suggest lack of cohesion and give negative optic".
Anoda post on X from Hamzat Jelili say: "E dey crystal clear say di president no dey aware of most appointments for dis administration.
Yet anoda user say: "Wetin be dis flip flop. You guys dey look uncoordinated and indecisive!"
But anoda user, Adunni TMO say "govment wey dey correct imsef no dey confused. E beta to do correction dan to allow mistake to continue in di name of wanting to look good".









