Video: Law enforcement raid American rapper Sean "Diddy" Combs properties afta sexual allegations

Sean Diddy

Wia dis foto come from, Getty Images

Published

Federal agents don raid di house of American rapper Sean "Diddy" Combs as dem kontinu dia investigation into case of sexual allegations.

Law enforcement dey probe into di sexual conduct of Sean Diddy and dem raid im house on Monday for Los Angeles and Miami.

Four women bin come out to accuse am, about three of which dey file under di New York Adult Survivors Act wey allow alleged victims of sex crimes to sue afta di statue of limitations don pass.

Di department of Homeland Security say dem dey pursue di "law enforcement actions as part of dia ongoing investigation" for New York, Los Angeles and Miami.

Dem search two properties for Los Angeles and Miami as part of di probe but di officials no specify di reasons why dem raid di house.

Wetin we call dis Video, Aerial footage show raids for Sean 'Diddy' Combs properties

Wetin happun between Sean Diddy and oda women

Na different lawsuits don accuse Mr Sean Combs of sexual misconduct but im attorneys bin deny all of di allegations wey dem make against Sean.

On Monday, di Homeland Security Investigations agents conduct operations for di 17,000 square foot mansion wia Mr Sean bin announce im latest album release last September.

Last year, R&B singer Cassie, wey her full name na Casandra Ventura, bin file a lawsuit for one New York federal court against Mr Sean. Di two bin date between 2005 and 2018.

For di court documents, she allege say she dey live inside serious abuse for di hands of di rapper, even though she later settle di lawsuit wit am.

Women wey accuse Sean Diddy of rape and abuse

Casandra "Cassie" Ventura

R&B artist, Casandra "Cassie" Ventura bin accuse am of rape and sex trafficking but dem reach settlement.

Cassie bin accuse Diddy say she bin dey trapped wit am for ten years for cycle of abuse and violence.

She say di rap producer bin rape and and beat am from wen she dey di age of 16 and e be 37 years old.

Di lawsuit call di music star say e be "serial domestic abuser wey go regularly dey beat Ms Ventura and leave am wit black eyes, wounds and blood."

Before di settlement, Oga Combs lawyer reveal say Cassie bin wan collect $30m if not she "go write damaging book about dia relationship".

Diddy lawyer wey im name be Benjamin Brafman say di lawsuit bin "get plenti baseless and outrageous lies".

Joi Dickerson-Neal

On 23 November, Joi Dickerson-Neal come out to accuse Diddy say e sexually assault am for 1991.

She say during dat time, di rapper drug am "wey make am dey di kain state wia she no fit stand or walk for her own".

Di lawsuit add say e come drive am go wia e dey stay and na for dia e sexually assault am.

Tok-tok pesin for Diddy send statement to di BBC say di allegations bin no dey credible and na "just moni grab and notin else."

Jane Doe 1

Jane Doe 1 na di third woman wey accuse Diddy say im and singer and songwriter Aaron Hall bin do turn by turn to rape am and her friend for either 1990 or 1991.

For di filing, Jane Doe 1 say she and her friend go one event for New York wey record company bin dey host and na dia dem meet Oga Combs amd Oga Hall.

Di woman say di two men bin give di two of dem drinks all night before inviting am back go Oga Hall house wia di woman claim she bin "dey pressured to sleep with Combs".

Rep pesin for Oga Combs say, "dis na fabricated claims wey dey falsely allege misconduct from ova 30 years ago and wey don dey filed for di last minute.

"E no pass moni grab. Na easy target im be for anonymous accusers wey dey lie... for financial benefit."

Jane Doe 2

Di fourth woman accuse Sean "Diddy" Combs say im and two oda pipo rape am.

She reveal for her court filing say di rapper bin fly am go im New York studio for 2003.

She say dem give am "plenti drugs and alcohol" before Diddy and di two oda men start to do turn by turn to rape am.

Di woman claim say she bin dey waka in and out of consciousness during di alleged mata and she bin dey di kain pain wey she no fit really stand, and no sabi how she take go back house.

She bin claim say na one of di oda two men wey dey di accuse bin meet am for lounge for Michigan come convince her say make she she fly private jet to meet Diddy.

Inside di accuse, dem add say one of di men bin force am to give am oral sex wey make Jane Doe 2 "to choke and dey struggle to breathe."

As dis latest accuse come out, Diddy send statement give BBC say "Enough is enough".