Arsenal bounce back to top Premier League afta 4-2 win over Aston Villa

Arsenal bounce back to top Premier League afta 4-2 win over Aston Villa

Wia dis foto come from, Getty Images

Published

Arsenal don return to di top of di Premier League afta a 4-2 victory over Aston Villa away.

Di gunners come from behind two times to beat Villa wey bin worry through out di game.

Na Watkins open scoring for Villa before Bukayo Saka equalise. Phillipe Coutinho den score di second for di home team.

Arsenal press sotay dem get 18 shots for second half alone - Zinchenko den level for di visitors before Emiliano Martinez score own goal from Jorginho shot and Martinelli icing for di last minute.

Wit dis win Arsenal retun to di top of di league wit 54 points ahead of Manchester City wey get 51 points. Dem dey play Nottingham Forest for anoda game.

Second Half

Aston Villa vs Arsenal

Wia dis foto come from, Getty Images

Full Time: Aston Villa 2-4 Arsenal

90+8mins: GOAL! Gabriel Martinelli beat di goalkeeper wit im effort.

90+6mins: SUBSTITUTION. Kieran Tierney enta for Oleksandr Zinchenko and Rob Holding enta for Martin Odegaard.

Aston Villa 2-3 Arsenal

90+3mins: GOAL! Emiliano Martinez score own goal!

90+1mins: 6 mins of added time.

89mins: Martin Odegaard swing a cross into di box.

87mins: Bukayo Saka get time and space inside di box afta e pick up a neat pass, but im shot too low towards.

85mins: YELLOW CARD for Emiliano Martinez for time wasting

84mins: Gabriel get header from di resulting free kick. But e lack accuracy.

83mins: Leon Bailey dribble deep into di box and release a strike towards di top right corner, but Aaron Ramsdale make a sensational reflex save!

81mins: Takehiro Tomiyasu attempt to send low pass into di box from di edge of di penalty area.

80mins: Leon Bailey run towards goal but di defender get back well to make good challenge.

79mins: SUBSTITUTION. Fabio Vieira replace Granit Xhaka. Takehiro Tomiyasu enta for Ben White

78mins: SUBSTITUTION. Jhon Duran enta for Ollie Watkins. Lucas Digne enta for Alex Moreno.

78mins: Good chance! Martin Odegaard nicely turn im man inside di box but place im effort just wide of di right post.

77mins: Bukayo Saka get on di end of pass and take a shot from di edge of di box.

76mins: John McGinn finds imself in space on di edge of di box and fire in a shot wey go towards di middle of di goal.

73mins: Matty Cash waste a good opportunity as im pass into di box no pass di gunners defence.

72mins: Arsenal take a short corner instead of sending di ball into di penalty area.

71mins: Gabriel Martinelli play a through ball inside di box, but e too strong and Emiliano Martinez come catch am.

68mins: SUBSTITUTION. Gabriel Martinelli enta for Leandro Trossard.

68mins: Alex Moreno give away a foul for a bad challenge.

67mins: SUBSTITUTION. Leon Bailey enta for Emiliano Buendia, Leander Dendoncker enta for Douglas Luiz

Aston Villa 2-2 Arsenal

64mins: Eddie Nketiah chop space inside di opposition box but waste di effort.

62mins: SUBSTITUTION. Jacob Ramsey enta for Philippe Coutinho.

61mins: GOAL! Great play by Martin Odegaard release Oleksandr Zinchenko in space and boom. Goal.

57mins: Eddie Nketiah get good opportunity wen e hold on to di ball.

56mins: Bukayo Saka don pick up a minor injury.

53mins: Oleksandr Zinchenko attempt to send over a cross in order to find one of im teammates, but opposition defender avert di danger.

53mins: Granit Xhaka find imself in a promising position afta receive good pass. E shoot but di ipposition defender block am.

52mins: Ref Simon Hooper see foul by Eddie Nketiah

49mins: Bukayo Saka hold on accurate pass on di edge of di box and immediately unleash a shot wey go off.

Aston Villa 2-1 Arsenal

46mins: Ollie Watkins get on di ball and beat an opponent

45mins: Second Half don start

First Half

Aston Villa 2-1 Arsenal

45mins: Half Time

44mins: Bukayo Saka do im best to hold di through ball, but e too strong.

43mins: Ollie Watkins try to hold on to a through ball, but e too long.

41mins: Bukayo Saka look to break free, but an opposing player clear di ball comot.

38mins: Dem clear di afta Emiliano Buendia attempt to dribble pass opposing player.

36mins: Bukayo Saka run enta to scaore goal but di defender make a good challenge.

Aston Villa 2-1 Arsenal

31mins: GOAL! Philippe Coutinho make am two for Villa.

30mins: Bukayo Saka try to send a low pass into di box, but dem block am. Arsenal get a corner.

28mins: Douglas Luiz try to bend in di free kick from distance, but Arsenal wall block am.

25mins: Martin Odegaard take di free kick for Arsenal, but ball dem clear am.

24mins: Matty Cash suppose know say wetin im don no make sense for dat foul wey e commit.

21mins: Good movement by Oleksandr Zinchenko but e fail to find any of im teammates as cross dey poor.

19mins: Oleksandr Zinchenko collect a simple pass and decide to shoot from distance.

Aston Villa1-1 Arsenal

16mins: GOAL! Bukayo Saka equalise for di gunners.

14mins: Leandro Trossard rolls di ball short to a teammate from di corner instead of sending a cross into di box.

13mins: Granit Xhaka try to send di ball in front of di goal, but di opposition defence avert di threat.

12mins: OFFSIDE. Flag up against Ben White.

10mins: Leandro Trossard commit rough challenge and Simon Hooper blow im whistle for foul.

9mins: Tyrone Mings make a rough challenge and referee blow for a foul.

8mins: Some neat passing and movement from Arsenal as dem dey ping around some short passes to create a chance.

Aston Villa 1-0 Arsenal

5mins: GOAL! Matty Cash provide better through pass for Ollie Watkins to beat Aaron Ramsdale.

3mins: Emiliano Buendia too dey aggressive for im attempt to get di ball from im opponent

2mins: Long-range effort by Douglas Luiz afta e receivd a good pass.

1min: KICK OFF

Aston Villa vs Arsenal line up

Arteta drop Gabriel Martinelli as Arsenal make two changes to dia starting line-up to face Aston Villa today.

Emile Smith Rowe dey bench afta e dey absent sake of injury.

Aston Villa: Martínez, Cash, Konsa, Mings, Moreno Lopera, McGinn, Douglas Luiz, Kamara, Buendía, Coutinho, Watkins

Arsenal: Ramsdale, White, Saliba, Gabriel, Zinchenko, Ødegaard, Jorginho, Xhaka, Saka, Nketiah, Trossard