OAU student land hospital afta washing clothes for 58 hours as she attempt to set Guinness World Record

Wia dis foto come from, Screenshot
One 200-level student of Obafemi Awolowo University, Ile-Ife Osun state, for south west Nigeria Subair Enitan, don land for hospital afta she wash clothes wit her ordinary hand for 58 hours for one "wash-a-thon".
Enitan initial plan na to wash clothes for 50 hours but she later end di marathon afta 58 hours- eight hours extra.
Di undergraduate for her attempt to break Guinness World Record begin di challenge on Friday 24 November for di Student Union Building Motor park inside di University campus.
Thousands of students, artistes and university officials bin rally round her to show support- Enitan mama also dey dia to ginger her pikin.
Enitan challenge na to set record for di longest hand cloth washing by one pesin afta she apply to di Guinness World Record last June.
She complete di 58 hours late on Monday night.
Tori be say di school ambulance bin take Enitan to di school clinic for medical check up immediately afta she finish. Reports say dem carry her go hospitalfor check-up afta she finish.
Video wey circulate for social media show as Enitan lie down for bed wit her hands wey white and wrinkle sake of di hand washing of clothes marathon
End of Di one wey oda users dey read well well
Before she bin go di clinic, Enitan bin tok say she dey fulfilled say her mama bin tanda wit her through di attempt.
“I dey very fulfilled to don complete di task right for di front of my mama, friends and colleagues wey gada for dis venue to show love and support my ambition” Enitan tok.
Guinness World Record neva comment about Enitan attempt.
GWR trend among Nigerians and how you fit break world record
Attempt to break Guinness World Record become trend among Nigerians afta one chef Hilda Baci break world record for di longest cooking hours for one pesin early dis year.
Afta Hilda cookathon, different ideas of attempt to break record don come up.
For early November, one woman, Helen Williams set di Guinness world record for making di longest hand-made wig.
Helen Williams bin make wig wey stretch up to 351.28m (1,152ft 5in).
Also for November one Tope Adebayo, wey pipo sabi as Tope Maggie, attempt Guinness Book of World Records as di chef wey cook for di longest time for di world.
Di Ogbomoso Chef wey base for Ibadan, Oyo State South West Nigeria bin declare im intention, for 140 Hours Cook-a-thon around June dis year.
Anoda Nigerian chef Damilola Adeparusi, bin also cook for Ilupeju, Oye Ekiti state, South West Nigeria.
Damilola Adeparusi AKA Chef Dammy, bin start her cooking for Friday 9 June.
Di current record holder for di longest cooking hour na, one Irish chef, Alan Fisher, e bin claim di record afta e cook for 119 hours 57 minutes, early for November.
How you fit apply to break Guinness World Record

Wia dis foto come from, GUINNESS WORLD RECORD
GWR give pipo opportunity to break records for different kain tins.
Di guide on how to register and break record dey for dia official website.
According to Guinness World Record, if you wish to break record wey dey exist or you wan set new record, and wan see di guidelines, you go need submit one online application first.
“Evri application for new record title dey reviewed individually by one expert and we dey unable to tell you if your record fit dey accepted by email or phone.
Also if you need ideas on wetin to choose, you go need check out wetin dey make Guinness World Records title or explore GWR records showcase for inspiration.
You go also need to visit GWR guide to evidence page so you go get idea of di evidence wey you need to provide as part of your record attempt.
Guinness World Record say dem no dey respond to postal enquiries so pesin go need to submit dia proposal through dia website.














