You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How Kenya Certificate of Secondary Education exams affect pipo wey dey use Telegram
Kenyans wey dey use Telegram dey complain say di app dey restricted as di Kenya Certificate of Secondary Education (KCSE) exams dey shele.
Users across Kenya dey report say dem don receive several error messages as dem try use di app.
For one circular wey BBC Pidgin take eye see, di Communications Authority of Kenya (CAK) allegedly direct internet providers to suspend di operation of Telegram for di kontri during KCSE exams.
For di circular wey dem date 31 October, CAK allegedly say e don get to dia attention say dem dey use Telegram to "perpetuate criminal activities, including compromising di integrity of di ongoing national examinations".
One internet observatory platform wey dey track cybersecurity and digital governance post metrics for dia X account wey show say Telegram dey restricted for Kenya.
Reactions from Kenyans
Kenyans on X dey vex say dem no fit use di app sake of say examinations dey go on.
Many of di pipo wey react on social media wonder why di authority go allegedly make dat kain decision sake of exam malpractice.
On Friday, Education Principal Secretary Belio Kipsang tok say only 11 incidents of attempted sneaking of mobile phones bin dey reported across di kontri.
While monitoring examinations in Kiambu County, di PS say na di fewest number of cheating cases di ministry don experience in recent times.