Nigeria record big setback for dia World Cup Qualifiers dream as dem play draw wit Zimbabwe for Uyo

Wia dis foto come from, X/@NGSuperEagles
Nigeria play draw with Zimbabwe for dia sixth 2026 World Cup qualifying match.
Nigeria bin expect to follow up dia away win by claiming anoda comfortable three points against Zimbabwe wey play 2-2 draw wit Benin, but e no happen.
Di game wey take place for Godswill Apkabio stadium for Uyo Akwa Ibom state get plenty drama with missed opportunities for di Super Eagles.
Tins bin look up for di Super Eagles for di 73rd minute wit goal by Osimhen before di end time 90th minute goal from Zimbabwe pour sand sand for di Super Eagles garri.
As tins be, South Africa wey win dia game siddon wit 13 points on top Group C while Nigeria dey number four with seven points.
Di game as e happun
SECOND HALF
90+5 FULL TIME - Referee blow final whistle
Nigeria 1 - 1 Zimbabwe
90+2 Corner kick for Nigeria, e dey cleared
90'' GOAL!!! Zimbabwe equalise for di dying minute
87'' SUBSTITUTION for NIgeria, Osimhen out for Boniface
85'' Zimbabwe make substitution
84 mins: Chance for Zimbabwe but Nwabali block am
76'' Very close call for Zimbabwe. E hit di cross bar!!!
73'' GOAL!!! Osimhen score for di Super Eagles.
Arokodare pass di ball to Aina for di side wey give am back to Osimhen for di final touch
Nigeria 1-0 Zimbabawe
68'' Anoda chance for Nigeria but Arokodare no fit control di ball. Nigeria just never fit convert any of di chances wey dem don get for di game.
64'' Back to back Corner for Nigeria but dem dey well defended by Zimbabwe
63'' Nigeria 0 - 0 Zimbabawe
62'' SUBSTITUTION for Zimbabwe. Walter out for Terrence
60'' Free kick taken by Lookman, but di defenders defend am well.
58'' SUBSTITUTION Chukwueze out for Arokodare
56'' Corner kick for Nigeria, Lookman take am straight into di hands of di goal keeper
55'' Zimbabwe fire shot outside di box but e no enter
51'' Camera just show Peter Obi for di stand, e wear Nigerian jersey
50'' Iwobi miss fantastic chance to put NIgeria in di lead
48'' Chance for Nigeria as Iwobi pass to Chukwueze but e make a wrong move and play am wide
46'' Second half don start
FIRST HALF
45 +2 Nigeria 0 - 0 Zimbabwe.
Referee blow whistle for Half Time
45'' Referee add two minutes extra time
45'' Nigeria dey try again, Iwobi get di ball and fire shot but e go over di bar
42'' Nigeria dey try hard to find di net, back to back but Zimbabwe defenders dey tight for di box and no dey gree dem
40'' 5 minutes to di end of di game and both sides still dey struggle to find di net
31'' Chance for Nigeria! Chukwueze fire shot but deflection and di goal keeper catch am easily
30'' 30 minutes of play and di game still dey goalless for di Uyo stadium
27'' Ekong concede throw in for Nigeria to avoid stories for di box
16'' Nigerians dey press Zimbabwe, Moses Simon get anoda chance for di box but again, na missed chance
15'' Nigerian Lookman get di ball inside di box and fire shot wey hit di bar
14'' Great chance for Zimbabwe, Walter catch di Nigerian defence and fire shot wey hit top of di net
12'' Anoda foul against Aina and Nigeria, Zimbabwe take am but e go over.
10'' Zimbabwe keeper dey down, e try to catch ball from di Nigerian player but injure imsef
8'' Lookman take di piece, Oshimhen head find di ball but dat na almost as di keeper catch am
7'' Corner kick for nIgeria, Lookman dey play am
7'' Zimbabawe with anoda chance but dem play a wide
3'' Foul against Nigeria by Chukwueze, Zimbabawe play di free kick but e no go anywhere
2'' Chance for Nigeria as Iwobi pass to Simon but e fire am straight enter Zimbabawe keeper hand
1'' Referee don blow whistle match don start
Line up - Nigeria

Wia dis foto come from, X/@NGSuperEagles
Di line up for di match don alreadi comot as di Super Eagles go dey defended by Aina and Osayi as wingbacks.
For midfield, na Ndidi and Iwobi dem go manage tins for dia.
While Victor Osimhen and Lookman go lead di attack line.
Odas na:
Nwabali,
Ekong,
Chuwueze,
Simon
Bassey.
SUBS
Bankole
Onyemaechi
Igoh
Arokodare
Aribo









