GES expel eight students becos dem yab President Akufo-Addo

Published

Kasala don burst afta di Ghana Education Service expel eight students for Chiana SHS say dem insult President Nana Akufo-Addo.

Chiana Senior High School dey for di Upper East Region for Ghana.

Di girls for video wey go viral bin tok about di parent of di president - "you dey siddon dia with your big head say you be our president", dem also tok.

According to one letter from di Ghana Education Service, "Management of di Ghana Education Service don give approval for di dismissal with immediate effect - dis na sake of say she chook her self for video wey she tok bad tins wey go viral".

Di letter go on to say, "e dey expected say your pikin go use dis as major turning point for her life".

Wetin di students tok about di president cause divided opinions as some pipo dey say na good tin say di school joinbodi sack di girls as e go serve as warning to oda pipo.

While odas dey tok say to dismiss di children pata-pata na ova kill and go destroy dia future.

Wetin pipo dey tok about di mata

Di Executive Director of Africa Education Watch Kofi Asare tok give tori pipo say, "I think di decision by di GES to dismiss di students although e dey unfortunate na step in di right direction.

"To ensure say Senior secondary schools na institutions to mould character, rules go dey wey go guide di behaviour and students and teachers, and if you go against am sanctions go dey.

"Howeva if di students feel say dem no do dem well, dem fit appeal to di appropriate bodis or go court sef."

Howeva di civil rights group OccupyGhana don hala ova di incident say na di president imself bin carry bill enta parliament wen im be Attorney-General to comot laws wey comot di law wey make "insulting di president" o be crime.

For dia statement, dem say, "we agree say wetin di students do dey terrible to direct at anyone let alone di pesin wey be President. Our culture and traditions no like dat kain tin so we no fit fault di GES sat dem wan discipline di students.

"But we live for liberal democracy wey wan make us tolerant and no over react for times like this. We believe sat if di students fo face disciplinary measures for wetin dem do to dismiss dem wey end dia education for public schooling system dey extreme and no match wetin dem do. We believe say suspension and compulsory counselling for di students go dey more effective."

Di Minority for di Ghana Parliament also gree say na overreaction to dismiss di girls and dey ask di GES to reverse di judgement.

Ranking Member on di Education Committee of Parliament, Peter Nortsu Kortoe bin tell local tori pipo, Citi News say "Wetin di students do dey bad, but we tink sat di punishment wey dem do di students dey harsh because e go affect di future life. Make GES recall di students and suspend dem instead".