Nollywood actor Alexx Ekubo take final journey home

Image of Alexx beside im coffin wearing white

Wia dis foto come from, BBC/Alexx Ekubo

Published
Read am in 4 mins

Nigerian actor, filmmaker and entertainer Alexx Ekubo wey die at di age of 40 dey take im final journey home today.

Dem go bury di late actor for Abia State wia family, friends and fans go gada to wish am final goodbye.

Alexx die on Monday, 11 May 2026 wia many of im colleagues and fans pay tribute to di talented actor.

Metastatic kidney cancer na wen cancer develop for di kidneys and spread to oda parts of di bodi.

Alreadi, dem do service of songs for Alexx on Wednesday, 10 June 2026 for Lagos and dem also do wake keep for am on Wednesday, 17 June 2026.

Alexx funeral service dey happun for Mary Slessor School, Amanagwu Village, Arochukwu, Abia State.

Di late actor interment go happun same Thursday 18 June for Ujari Village, Arochukwu, Abia State.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Image of Alexx Ekubo
Image of Alexx coffin

Who be Alexx Ekubo

According to im bio ontop im official website, dem born Alexx Ekubo for April 10, 1986 for Port Harcourt, Rivers State Nigeria.

E bin train as lawyer for di University of Calabar, but na inside acting e really shine and later see fame.

Alexx win best supporting actor for di 2013 Best of Nollywood Awards ontop im role inside di feem Weekend Getaway.

For 2018, e gbab Special Recogition Award from di Nigerian First Lady say dem dey torchlight im contribution to di development of di Nigerian Entertainment Industry.

For 2020, Alexx bin dey inducted into di MIPAD/United Nations (Most Influential People of African Descent) Top 100 under 40 years hall of fame.

Alexx bin reveal anoda of im achievement as di governing council of the Institut Supérieur de Communication et de Gestion (ISCG UNIVERSITY) confer am wit Doctorate (Honorary) Degree in Arts & Culture for 2021.

E bin also collect di Nigerian National Award of Excellence wey im bin get for im charity work as di Global Social giving actor of di year.

Although im first major role as actor na Ladies Men.

As actor, Alexx get 116 credits for im feem role.

Di latest feem wey comot wit am comot for February dis year wey dem call Adanne.

Oda feems na Áfàméfùnà: An Nwa Boi Story, A Sunda Affair, Hire a Woman, Omo Ghetto - The Saga among odas.

Di 40 year old acor don collect nine awards wey im don collect ova di course of im career.

E bin collect di Black Entertainment Film, Fashion, Television, & Arts Award, London (BEFFTA) for Nollywood Rising Star and di Screen Nation Film & Tv Award (London) for Favorite Male African International Emerging Screen Talent for 2014.

For 2015, e collect di Nigerian Teen Choice Award for Outstanding TV Personality.

For 2016, e bag Best Actor of di year from Best of Nollywood and Model Actor of di year from di Nigerian Model Achievers Award.

For 2022, e win Best Lead actor for di Best of Nollywood and di Best Actor of di year from di Toronto International Nollywood Film Festival.

For 2024, e bin dey nominated for AMVCA for Best Supporting Actor for im role inside di feem, Áfàméfùnà.

A man wit different faces