Muhammed Babangida accept appointment as BOA chairman?

Published
Read am in 3 mins

Recently Nigeria president Bola Tinubu appoint Muhammed Babangida, son of former military head of state General Ibrahim Babangida (rtd) as oga of Bank of Agriculture.

Since di appointment, na silence follow as e be like say nothing big don happun.

Few days afta di announcement tori burst out for social media say Babangida no gree take di appointment.

But Nigerian Presidency say Muhammed Babangida don accept im new appointment as di chairman of di Bank of Agriculture contrary to wetin pipo dey tok.

Dis na according to statement wey di President Tinubu special assistant on social media, Dada Olusegun bring come outside.

Di statement reveal say, oga Babangida even thank di president say im trust am wit appointment.

Oga Olusegun also quote oga Babangida say im "dismiss as lie and malicious, di tori wey dey go around online wey suggest say e reject di appointment. E call am deliberate attempt to mislead kontri pipo and spoil di image of di Tinubu administration".

Despite di statement from di presidency, who sign am neva clear.

Oga Muhammed Babangida no get any verified social media handle wia e don tok about di appointment.

Dis dey come a day afta one statement wey bin dey linked to d pikin of di former head of states, wia e allegedly tok say e reject di appointment sake of say, personal and professional mata wey dey for im plate, e no go fit to accept di role.

But di presidential special assistant quote am say im say, "we wan make di public know say di pipo wey dey fake di fake news go dey investigated well-well and dem go dey brought to justice".

Muhammed Babangida appointment bin dey part of plenti appointments wey President Tinubu announce on Friday 18 July across goment institutions.

E bin dey appointed to di Bank of Agriculture togeda wit Lydia Kalat Musa (Kaduna State) wey get Chairman, Oil and Gas Free Zone Authority (OGFZA) and Jamilu Wada Aliyu (Kano State) wey get Chairman, National Educational Research and Development Council (NERDC).

Oda latest appointment na Yahuza Ado Inuwa (Kano State) wey bin get di Standard Organisation of Nigeria (SON) chairman; and Sanusi Musa (SAN, Kano State) as di Chairman of di Institute of Peace and Conflict Resolution(IPCR)

Wetin be di Bank of Agriculture?

Di Nigerian Bank of Africulture (BOA) Limited bin start as di Nigerian Agricultural Bank (NAB) for 1972 and start operations for 1973.

Dem change di name again for 1978 to di Nigeria Agricultural & Co-operative Bank Limited (NACB), den again for 2000 wen dem change di name to di Nigeria Agricultural Cooperative & Rural Development Bank Limited (NACRDB) wen dem bin combine wit di now dead People's Bank of Nigeria (PBN), and di Family Economic Advancement Programme (FEAP).

Na until 2010 dem name am di Bank of Agriculture Limited (BOA).

E start to carry out di functions of Development Finance Institution (DFI) for di Agricultural and Rural Development sector.

Na di Federal goment of Nigeria get am fully and dem own am through di Federal Ministry of Finance Incorporated (MOFI) and Central Bank of Nigeria (CBN) wit 60%:40%.

E currently be di biggest agricultural financial institution for Nigeria