'25 pipo kpai and dem bury dem for captivity, snake bite three pipo' and oda tins wey victims say happun to Kwara State abductees

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Makuochi Okafor
- Role, BBC News
- Published
- Read am in 5 mins
Relatives of di pipo wey dem rescue from kidnappers hand for Kwara State still dey tok about di trauma wey dem face wen dia loved ones bin dey miss.
Tori be say communities for Kaiama Local Govment Area raised and offer more dan N180 million naira so dem fit secure di release of di victims, but di kidnappers reject di amount, sake of say e too small.
Di kidnappers bin also tell di communities make dem beg di Kwara and Niger state govments for support, wit hope say dem go bring big money for ransom payment.
Di kidnappers even threaten to force di young girls into marriage and kpai di women wey don old if dem no negotiation well for dia release.
Some of di villagers narrate dia experience how e be for dem wen dem bin kidnap dia loved ones.
'For our house dem kidnap seven pipon - villager
Elder broda to di village head, Alhaji Abdul Ibrahim confam to di BBC say dem try evritime possible sotay dem even contribute money to rescue villagers wey jaguda pipo kidnap.
"Di bandits no request for any money, but wen dem release di first and second speech of our wives, becos dem tell us say make we try to sake of say dia lives dey in danger, dem tell us say dem dey eat but dia lives dey in danger make we come save dem. Wetin we go do wen govment no listen to us, we gatz contribute, and wen we bin carry dis money go give dem, na dat time we know say dem need money becos dem tell us say di money wey we carry go dia too small."
Oga Ibrahim claim say di bandits threaten dem say dem go marry dia fine fine girls out.
Abdul Ismaila wey be vigilante and engineer also tok say "di jaguda pipo dey disturb us for farm well-well and we want govment to take action."
Anoda villager tell di BBC say wen dem bin hear tori say dem don release Woro kidnap victims, dem bin no beliv di tori untill dem see dem wia dia eyes. Im explain how di absence of im loved ones affect im life.
"My senior broda get three wives and dem bin kidnap two of dem go forest plus im two daughters. Dem still kidnap one of my junior broda son. For our house dem kidnap seven pipo."
Di smile for im face show how happy wey im dey as im tok say dem bin no first beliv di tori of dia release.
"Na for market some of our pipo confam say dem see dem iside buses wey carry dem come and dem recognise some of di pipo wey dey inside di bus, dat day I happy well-well sotay I no fit eat sef. Body sweet me like say we dey do Sallah for our community"
Even as im dey happy, im say im biggest fear na make dem no come attack di community again.
Details wey emerge say na about 308 pipo wey Nigerian authorities say dem rescue from kidnappers den.
Dis latest release na wetin dem describe as di kontri "largest single-day operation" wey involve joint security forces.
Among dose wey dem release na 163 pipo from Nigeria north-western Kwara State, wey kidnappers abduct during February attack on two communities for Kaiama district, Woro and Nuku.
Kwara State lawmaker Abdullahi Halidu Danbaba, wey dey represent Woro constituency, tell di BBC on Thursday say some of di victims describe di kain harsh conditions dem experience while dem dey for captivity.
"Dem go through veri difficult ordeal. One woman say three pipo dey bitten by snakes. She also say about 25 pipo die for dia and dem bury dem at di location," e tok.
Di released group include women, children and elderly pipo, many of dem dey for poor health.
Danbaba say afta di victims arrive for Ilorin, di state capital, "about 40 pipo dey rushed to di hospital for medical attention".
Dem take di victims first to military facility for neighbouring Niger State, wia dem receive medical attention, bifor dem hand dem ova to di Kwara State govment to reunite wit dia families.
Di victims dey among more dan 100 pipo wey dem abduct for February wen armed attackers storm di two communities on motorbikes.
Di attackers, wey authorities decribe as jihadists wear military-style uniforms, kill more dan 100 pipo during di assault.
Amnesty International say dem find some of dose killed wit dia hands and feet tied, while dem shoot odas or dem don cut dia throats.
Videos released by di kidnappers weeks afta di attack show several women and young children, including toddlers, among dose wey dem hold.
Danbaba say women bin give birth while dem dey for captivity and return wit dia babies.
"Two women bin give birth for captivity and return wit dia babies witout any proper medical care," e tok.
E add say "some of di older pipo among dem help take care of di babies".
Di lawmaker say di victims tell am say dem "give dem food only once a day".
Danbaba also say some teenage boys remain for captivity.
Di presidency wey first announce di release no disclose dis part of di tori.
"E also get some young boys between di ages of 13 and 15 or 16 wey dem no release. Dem still hold dem for dia."
According to di victims, di lawmaker say kidnappers dey plan to recruit dem into dia group.
Di Nigerian govment don blame Boko Haram militants for di attack, saying di communities dey targeted for refusing to accept strict interpretation of Islam.
Afta di attack, Amnesty International say di militants dey distribute leaflets for di two villages for several months bifor di killings.
Danbaba say e remain unclear how di authorities secure di release of di victims.
"Di only tin we know na say dem don rescue dem" e tok.
E say di community don "already give up hope" afta months of uncertainty since di attack on 3 February.
"We dey grateful to our Govnor, AbdulRahman AbdulRazaq, di President, Bola Ahmed Tinubu, and di security agencies wey make efforts to rescue dem."










