Wetin go happun next as Inec publish details of political party candidates for 2027 elections

Wia dis foto come from, Bola Tinubu/Peter Obi/Atiku Abubakar/Omoyele Sowore
Di Independent National Electoral Commission (Inec), don begin dey display di personal details of candidates wey dia political parties nominate for di 2027 general elections.
Publication of di candidate personal particulars dey in line wit di Electoral Act 2026 and according to di 2027 election timetable.
"Independent National Electoral Commission (Inec), Federal Capital Territory (FCT), don begin di public display of di personal particulars of candidates nominated by political parties for di 2027 General Elections, in compliance wit di provisions of di Electoral Act, 2026."
According to Inec, di display exercise take for state head office for Abuja and across di six area councils for di FCT and di aim na to promote transparency.
Inec add say part of why dem do di display of candidates particulars na 'provide members of di public wit di opportunity to check di credentials and oda particulars wey di candidates wey dey seek elective offices submit to dem.'
According to di Inec timetable, afta submission of nomination forms by political parties, di next tin wey Inec go do na to publish di details of di candidates.
Dis dey in line wit section 29(3) of di Electoral Act 2026 wey state di publication of di candidate list within 21 days wey dem receive am.
Na 1 August, 2026 Inec publish names of presidential and National Assembly candidates while dat of govnorship and State Houses of Assembly dey expected to come out on 29 August, 2026.
Dis publication dey open to di public to check di kain qualifications and oda credentials wey di candidates submit to Inec for di 2027 election.
Which candidate Inec publish dia particulars
According to di Resident Electoral Commissioner (REC) of FCT, during di exercise, e maintain say di publication of di candidates particular dey required under section 29(3) of di Electoral Act, 2026.
According to di Electoral Act 2026, e give Inec di mandate to display di personal particulars, affidavits and oda relevant documents of candidates for di constituencies wia dem intend to contest elections.
"Di display cover Presidential candidates and National Assembly candidates wey dey contest elections for di Federal Capital Territory."
"Di display of candidates particulars na important aspect of di electoral process, as e go help openness, accountability and public confidence in di conduct of elections."
FCT REC say make di public try check di particulars well so dem go fit take note of di information wey di candidates provide.
E add say Inec go follow di scheduled timetable for di 2027 general elections and go carry out every stage of di process, say dem go conduct free and fair election.
Wetin go happun next afta publication of candidate list
Wit dis publication, political parties go fit begin campaigns ahead of di 2027 general elections starting wit di presidential and National Assembly, bifor state go kon follow.
Also, di Inec timetable still make am possible for political parties to withdraw and replace candidates - in line wit Section 31 of di Electoral Act 2026 wey provide not later dan 90 days to di election.
Political parties get till 22 August and 19 September for withdrawal of any candidate wey dem wan replace for federal and state seats respectively.
Again, afta di whole activities, Inec go kon still publish anoda final list of candidates and dia parties, at least 60 days bifor di elections.
Dis final list go remain unchanged till election date, and campaigns go continue for di parties.









