Ghanaians, Zimbabweans among 127 foreigners arrested as South Africa Home Affairs set to deport illegal immigrants

Wia dis foto come from, Ihsaan Haffejee/Anadolu via Getty Images
South Africa police say dem don arrest about 127 foreign nations wey no dey documented for di kontri.
Dis na part of di new operation wey di South Africa police carry out as part of dia efforts to curb illegal immigration.
For different operations across di kontri, di police and di South Africa Department of Home Affairs announce arrest of undocumented foreign nationals wey dey live for different parts of di kontri.
According to South Africa Minister of Home Affairs, Leon Schreiber, e say di dozens of illegal immigrants wey dem arrest go chop deportation wey dey according to law.
Dis no be di first time wey di Home Affairs go announce di arrest of foreign nationals for di kontri.
South Africa police and Home Affairs collabo to dey carry out di raid of illegal foreign nationals for kontri.
Meanwhile, di South African govment say dem dey work hard to make sure say dia citizens wey engage for unlawful anti-immigration activities face justice.
South Africa President Cyril Ramaphosa bin react again during di week to di rising anti-migrants violence for di kontri as e clear say nobody get di right to make migrants scapegoats for unemployment, crime or shortcomings for di delivery of public services.
Nigeria and Ghana dey put pressure ontop African Union (AU) to take stand ontop di attacks on national foreigners wey dey shelle for South Africa.
Dis new arrests across South Africa by security agencies na to address wetin di kontri describe as illegal migration of foreign nationals as South Africans also accuse di foreigners of taking dia jobs.
'Dozens arrested for lawful deportation' - Minister
According to South Africa Home Affairs minister, e say dem conduct operation for di streets of Pretoria wey lead to di arrest of di illegal immigrants.
"Operation New Broom hit di streets of Pretoria yesterday, wia dozens of illegal immigrants dey arrested for lawful deportation."
Di minister say di Home Affairs no go gree for illegal immigrants, as im department gop kontinue dey work to 'restore di rule of law' as e dey for South Africa constitution.
Di police statement wey dem release on on Friday evening show say dem don gbab about 24 foreign nationals wey dem tag as undocumented.
South Africa police say dis particular operation prosper wey dem carry out on Wednesday 29 July, for Stilfontein, one part of di kontri, target illegal mining activities.
"Intelligence-driven Operation Prosper, targeting illegal mining activities for Stilfontein result in di arrest of 24 undocumented foreign nationals and one suspect for bribery."
According to di police, dem carry out di operation sake of di information and intelligence wey dem receive say illegal mining activities dey go on for di area.
Dem say di suspects dey allegedly 'extract gold-bearing material and dey transport am to illegal melting facilities.'

Wia dis foto come from, EMMANUEL CROSET / AFP via Getty Images
Ghanaians, Zimbabweans among arrested 127 foreign nationals for South Africa
Di South African Police for Limpopo say dem carry out operation for five districts for di province wia dem gbab 127 foreign nationals wey no dey documented.
Dem say di operation include 'stop-and-searches, roadblocks, compliance inspections and verification of undocumented foreign nationals.
Citizens of Ghana, Zimbabwe and Ethiopia dey among di foreigners wey di police gbab as dem accuse dem say dem go against di Immigration Act.
"Di integrated operation result in di repatriation of 115 undocumented Zimbabwean nationals. Twelve undocumented foreign nationals, nine Ethiopians and three Ghanaians, chop arrest for going against di Immigration Act."
Di police also say dem arrest three employers wey also allegedly employ undocumented foreign nationals.
Di operation wey dem carry out na in collaboration wit oda law enforcement agencies as dem also arrest suspects wey also dey wanted bifor for different offences.
Meanwhile, for mid-July, South Africa bin arrest ova 1,200 suspects including 159 undocumented foreign nationals wey dem say go against di immigration act.
South Africa police say dem pack di undocumented foreign nationals for Gauteng province of South Africa during dia operation shanela.
Di arrest dey come weeks afta di rainbow kontri carry out one of dia biggest crackdowns on undocumented migrants in years, following weeks of anti-immigration protests wey see violence, intimidation and looting.









