Wafcon 2026: Cameroon, Morocco, Malawi and Algeria battle for final spot

Wia dis foto come from, Getty Images
Di semi-finals of di 2026 Women Africa Cup of Nations go happun on Wednesday for di Moulay El Hassan stadium, Rabat, Morocco.
North African side Algeria go face dia Southeastern opponent Malawi for di first semi-final.
Host kontri Morocco go kwanta wit Cameroon for di second semi-final.
As Nigeria comot for dI quarter-finals stage for di ongoing Women Africa Cup of Nations (Wafcon) 2026, e give oda kontris chance to become champions.
Nigeria wey don win di title record 10 times don create chance for new winners to emerge.
All di four semi-finalists neva win Wafcon title bifor.
Algeria vs Malawi match stats
Dis na di first meeting between Malawi and Algeria for any Wafcon tournament.
Di kontri wey go win dis match go become di seventh different nation to reach di final since di first tournament under di current format in 1998.
Di six finalists since 1998 na Nigeria, Ghana, South Africa, Cameroon, Equatorial Guinea and Morocco.
Di tournament go get first-time champion for di second time in three editions, afta South Africa bin win dia first title for 2022 and Nigeria win di 2024 edition.
Di match go be Algeria second Wafcon game against first timers Malawi.
Dis na Algeria first Wafcon knockout game against any Southern African kontri.
Malawi na di only second national team from di kontri across senior and youth men and women football, to qualify for di Fifa World Cup tournament.
Malawi na di first Wafon newcomers since Zimbabwe in 2000 to reach di semi-finals.
Malawi na di only third first timers since 1998 wey don progress beyond di group stage, afta Zimbabwe in 2000 and Botswana in 2022, and dem be di first of di three to reach di semi-finals since Zimbabwe.
Algeria win Wafcon knockout game for di first time wit dia 2-1 comeback victory over Côte d'Ivoire for di quarter-finals.
Na Algeria first semi-finals be dis and dem also qualified for di Fifa Women World Cup for di first time.
Morocco vs Cameroon match stats
Dis na di second time di two kontris dey meet for Wafcon Cameroon bin beat Morocco 4-1 wen dem bin meet for group stage for di 2000 tournament.
Cameroon bin don lose five games back to back against Wafcon hosts bifor dem draw dia most recent 1-1 with Ghana for di 2018 group stage.
Cameroon don concede 17 goals and scored just one for six games against Wafcon hosts.
Cameroon neva score first against Wafcon host kontri dem dey always concede first.
Na Morocco third successive semi-final, and third overall, wit 2-1 win over South Africa for di quarter-finals.
Dem don qualified for di Fifa Women World Cup Brazil 2027. E go be dia second for di tournament afta dem reach di 16 for di 2023 tournament.
Morocco win dia past two semi-finals, di two matches enta extra time and penalties.









