You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin we know about Uganda bus accident wey kill 20 school children
Na at least 20 schoolchildren and one adult die inside one road accident wey happun for Uganda.
According to officials, di accident happun to bus wey bin dey carry pupils for study trip.
Dem say dis na one of Uganda deadliest road accidents in recent years wey involve children.
Di accident happun for Kapchorwa area of Uganda for Thursday evening wen di school bus bin dey carry children and teacher on field trip.
Several odas also injure for di accident wey include school staff wey follow di bus go di field trip.
Di bus wey dey involved for di crash na one Isuzu bus, wey belong to King David Junior School, Ndejje, Makindye Division, Kampala. Dem neva identify di driver yet.
Michael Kananura wey be di Public Relations Officer for di Directorate of Traffic and Road Safety say dem confam say na total of 21 pipo die for di accident.
"We wish to confam say, sake of di fatal road traffic crash wey occur yesterday evening for Chekwatit Village, Kimawa Parish, Kawowo Sub-county, Kapchorwa District, total of 21 pipo, comprising 20 pupils and one adult, so far dey confamd dead."
Preliminary investigations show say di bus suffer mechanical fault bifor di driver come lose control for Chekwatit Hill - local officials say dat road dey known for several serious accidents.
How di accident take happun
Di accident happun wen di children dey return from dia field trip, bifor di driver lose control of di vehicle and hit head ontop big stone.
Wen di accident happun, police and oda emergency responders quickly go di scene to begin rescue operation to know how many casualties dey involved.
"Di driver reportedly lose control of di vehicle, wey come run comot for di road, hit one big stone wey dey by di roadside and e come somersault," police tok.
"Sadly, 20 children and 1 adult, wey happun to be di founder and director, Mr Tadeo Ssekade, don go be wit di Lord," Minister of Local Govment, Balaam Ateenyi Barugahara post on X, while at di scene.
Meanwhile, some of di survivors of di accident wey dia identity neva clear dey rushed to Kaserem Health Centre IV, Kapchorwa General Hospital, and Mbale Regional Referral Hospital for quick medical treatment.
Also, dem carry di bodis of di deceased to Kapchorwa Mortuary till dem fit. identify and and do post-mortem examinations.
Police say more investigations into di real cause of di crash dey go on.
Videos wey eyewitnesses share for social media show how di bus dey badly damaged, as local residents rush to help di injured children.
Uganda dey record thousands of road deaths evri year, wit speeding, poor vehicles and dangerous roads among di leading causes of di deaths, according to traffic authorities.
Dis latest crash dey come as plenti concern dey ova di safety of school transport afta several serious bus accidents happun for Uganda in recent weeks.