Chelsea 0-1 Arsenal: How Arsenal return to top of Premier League as Chelsea suffer defeat

Published

Arsenal don return to di top of di Premier League table as Gabriel close-range finish give dem victory away to Chelsea for Stamford Bridge.

Gabriel pounce to steer di ball over di line for di 63rd minute, after di hosts fail to deal with Bukayo Sako corner from di right wing, to give di Gunners one deserved lead.

Dem bin create di best chances when e dey goalless but Gabriel Martinelli curle one shot over di crossbar and Gabriel Jesus fail to hit di target with one diving header when unmarked.

Chelsea, with ex-Arsenal captain Pierre-Emerick Aubameyang failing to make impact against im former side, struggle to create clear-cut chances and now dey without a win for four Premier League matches.

Arsenal bin lose top spot on Saturday when 10-man Manchester City beat Fulham 2-1 thanks to Erling Haaland wey win penalty for di fifth minute of injury time, but dis win take them two points clear of Pep Guardiola side after 13 matches.

FIRST HALF

KICK-OFF

Arsenal wan top spot back, Chelsea wan to right dia patchy Premier League form.

Match don begin

1 min' Thomas Partey launch one ogbonge old long throw into di Chelsea box and Gabriel meet am with im head, but only to send di ball harmlessly wide.

6 min' Arsenal dey start brightly.

Dem don get one corner, wey dey swing to di near post but dey head away by one Chelsea player.

11 mins E dey simmer nicely.

Arsenal dey on di front foot, Chelsea dey look to wrestle back some control and break when dem fit.

Ben White dey forced into action for di other end, with two clearing headers, before Granit Xhaka head back to Aaron Ramsdale to relieve di pressure.

18 mins' Gabriel Martinelli go for glory from outside di box but im angled curling effort go well over.

Just to spark one bit of home fan ire, Benjamin Mendy hit im goal-kick straight out of play.

Dis place dey wait for someone to show dem things go dey go OK.

21 mins' Thiago Silva stop Jesus' shot. Baba continue to dey go very strong at 38.

27 mins' Well, not really a chance for di end.

Marc Cucurella swing di ball in and e glance to Trevor Chalobah on di far side of di box. Im chipped ball back in is soft and easy for di Gunners to clear.

27 mins' YELLOW CARD

Oh, dis dey naughty. Or na poor timing?

Pierre-Emerick Aubameyang dive in to try and tackle Ben White but na di defender boot e catch.

Mikel Arteta dey furious. Di ref respond with one yellow for di Chelsea forward.

31 mins' Chelsea don win dia first corner.

Na Thiago Silva di ball meet but e get plenti of players around am and fit only head harmlessly over di bar.

37 mins' When Kai Havertz no dey pick di wrong option e dey execute di right one badly.

E fire one cross way too hard at Mason Mount, giving di England player no chance of controlling am. Na decent opening for Chelsea too.

41 mins' Mason Mount dey try im best to be di driving force for Chelsea.

42 mins' YELLOW CARD

A little battle begin brew between Bukayo Saka and Marc Cucurella. Di latter stop di former breaking, sending di Arsenal man to di ground. No free-kick.

Saka get to him feet, chase down Cucurella and clatters am. Dat na foul and a yellow card.

43 mins' Mikel Arteta dey spit feathers.

E dey vex say dem award foul ontop di tackle on Saka.

45+1 mins HALF TIME

Chelsea deal with di Arsenal corner and dat na di break.

Gabriel Jesus get di golden opportunity for dat half, but head wide to continue im barren spell in front of goal.

Lots of huff and puff, but not enough quality.

SECOND HALF

KICK-OFF

No change rom either side.

Shey dem fit find a bit more class and composure for di final third for di next 45 minutes?

47 mins' Woeful corner.

Saka hit straight at Pierre-Emerick Aubameyang, who head am away.

50 mins' YELLOW CARD

Two Chelsea corners for quick succession.

Arsenal get di ball away before Cesar Azpilicueta fly in on Gabriel Martinelli. E touch am, dem sama yellow card.

GOAL - Chelsea 0-1 Arsenal

Gabriel give Arsenal ogbonge goal wey dem bin dey wait for

68 mins' Chelsea dey all over di shop now.

Oleksandr Zinchenko cross from di left breaks to Bukayo Saka on di opposite side of di box. E take one touch and sky im effort.

70 mins' Shey Chelsea fit dig themselves out of dis hole.

Dem never really offer much dis half to really threaten Arsenal.

77 mins' Arsenal dey win all di 50-50 challenges.

Chelsea no fit get di ball away from dia own box.

80 mins' YELLOW CARD

One booking for Ben White sake of say e take too long over a free-kick.

81 mins' Video Assistant Referee

Big shouts for penalty to Arsenal for handball against Marc Cucurella.

Di ball definitely hit im outstretched arm. but shey e dey penalty area? E dey right on di corner.

81 mins' No penalty.

86 mins' YELLOW CARD

Five minutes to go.

As e stand now, Arsenal dey head to di top of di league.

Conor Gallagher chop yellow card for dragging back Kieran Tierney.

90 mins' Dem go add five more minutes. Chelsea still get hope.

Wetin di Blues fit do for dis additional time?

90+6 mins'

FULL-TIME

Huge win for Arsenal!

Dem fight for am, but na dem be di better side here. Gabriel point-blank finish from Bukayo Saka corner na im settles am.

Di Gunners replace Manchester City for di top again.

Head-to-head

Arsenal dey go for dia three consecutive league games away to Chelsea for di first time since 1974.

Di Gunners don win three of dia past four Premier League fixtures versus di Blues. Before dis time , na only two victories for 17 top-flight meetings dem don get(D6, L9).

Chelsea

Chelsea dey unbeaten for 12 home matches for all competitions since dem lose 4-2 to Arsenal on 20 April (W7, D5).

Di Blues don win only one of dia last 12 top-flight home games against di established top six clubs - a 2-0 victory versus Tottenham for January 2022.

Pierre-Emerick Aubameyang fit become di second player, after Cesc Fabregas, to score for both Arsenal and Chelsea for Premier League matches between di clubs.

Aubameyang score 68 times for 128 top-flight appearances for di Gunners between 2018 and 2021.

Raheem Sterling get eight Premier League goals versus Arsenal - di only teams wey im don get beta record against na Bournemouth and Watford, with nine goals apiece.

Arsenal

Arsenal don win 10 of dia 12 top-flight matches dis season. Only one of di 10 previous sides to win plenti times for dis stage of a Premier League campaign and dem no go on to win di title - Newcastle in 1995-96.

Di Gunners get victories in just five of dia past 50 league games away to Chelsea, Liverpool, Manchester City, Manchester United and Tottenham.

Mikel Arteta's side don win all four of dia London derbies dis season. for 2021-22 dem win five of 10 derbies in di league (D1, L4).

Gabriel Martinelli get five goals for 12 Premier League games dis season. E dey short of only one di highest figure in a single campaign.

Gabriel Jesus don failed to score for each of im eight most recent appearances in league and cup.