Orji Kalu: Why Supreme court cancel former governor of Abia State conviction

Di Economic and Financial Crimes Commission of Nigeria say dem don ready for fresha and anoda trial of di former Govnor of Abia state Orji Kalu.
Dis wan dey come afta di Supreme Court of Nigeria nullify di trial of di former governor of Abia State, Orji Kalu, and others, wey dem bin don convict and sentence for December 2019, for accuse of one N7.65billion ($19.6m) fraud dem do.
EFCC say di judgement dey unfortunate and na technical ambush against di trial of di former govnor.
Why court cancel Kalu conviction
On Friday, Justice Mohammed Idris, wey dem elevate to di Court of Appeal, return to di Federal High Court for Lagos to complete di case wey start in 2007.
Di judge bin don sentence di ex-governor to 12 years imprisonment for di magomago e allegedly commit wen im be di Abia State governor.
But for today judgement, Justice Ejembi Eko wey deliver di judgement say all di judges of di highest Court don hear I'm appeal and dem don agree wit one voice say dey judgement wey put Orji Uzo Kalu for prison no hold water.
Di Apex Court say Justice Mohammed Idris, wey send Kalu to prison for corruption no get di power to sentence di former governor as dem don already promote am to justice of di court of Appeal.
Justice Mohammed Idris of the Federal High Court for Lagos on the 24th April bin sentence Senator Kalu to 12 years for prison and Ude Udeogu wey be Abia state director of Finance and Account to 10 years in prison di same day.
End of Di one wey oda users dey read well well
Both senator Kalu and Udeogu bin cari cry go Supreme Court to challenge di verdict of di Lagos High Court.
Dia cry be say di judge no get di power to sentence dem to prison. But afta di Supreme Court judge hear dia appeal, Justice Eko come say true-true, justice of court of Appeal no get power to deliver judgement for any Federal High Court.
E say Justice of the Court of Appeal no fit operate as a judge of the Federal High Court and as such di sentence wey e give Senator Kalu dey null and void.
Di court come order di Chief Judge of di Federal High Court make e re-assign di case for trial.
Former Govnor Orji Uzor Kalu bin don collect 12 years imprisonment sentence from Justice Mohammed Idris of di Federal High Court for Ikoyi Lagos, Nigeria.
Dis na afta di court torchlight say Kalu, and two odas dey guilty of N7.65billion ($19.6m) fraud.
Di mata relate to di time wey oga Kalu bin govnor for Abia State although im later comot office to become Senator.
'Supreme court judgement dey on point'
Nigerians don dey react to di judgement.
Senior Advocate of Nigeria (SAN) Jibrin Okutepa say di Supreme court na di highest court for di land and im judgement on to Orji Uzor Kalu corruption mata dey in tandem wit di law.
E xplain give further say di court judgement dey try maintain di sanctity of di law but weda di judgement meet di expectation of di Nigerian pipo na different tori.
E explain give say dis no be di first time di Supreme Court of Nigeria dey give dis kain judgement and dat for June 17, 1977 dem pass the same judgement wen
Di den Justice Philip Nnaemeka -Agu for Anambra state bin pass judgement on top land mata between Obi Okudo and Obianwuna Ogbunyiya.
Di two pipo dey fight on top ownership of one land for Oboh -Ogidi for Anambra state. Before di date of judgement, dem come promote oga justice Nnaemaka to justice of the Court of Appeal from di High Court.
But despite im promotion, e still pass judgement for di mata in favour of Okudo and ask Obianwuna make e no venture enta di land or trespass at all.
But Obianwuna lawyer cari di mata enta Supreme court to challenge say Justice Nnaemeka no get di powers to give di judgement and so make di court declare di mata null and void and di Supreme Court den listen to am and declare say di mata no hold water.
We don update dis tori.











