Abdulkadir Balarabe Musa: Biography of Alhaji Balarabe Musa, Kaduna former Governor

Published
Read am in 3 mins

Abdulkadir Balarabe Musa, Former govnor of Kaduna State, don die.

Oga Musa die for Kaduna town at di age of 84, afta long sickness, according to one of im sons wey confam in death to BBC.

Oga Balarabe Musa na di first civilian govnor of di old Kaduna State for north west Nigeria.

Im die afta a long sickness. Former Kaduna Senator Shehu Sani also confam Balarabe Musa for im twitter post.

Alhaji Balarabe Musa Biography

Abdulkadir Balarabe Musa na ogbonge Nigerian politician wey dem born for 21 August 1936 for Kaya, Kaduna State.

He study for Zaria Middle School from 1947 - 1952. From there he go di Institute of Administration, Zaria from 1952-1953.

Late Balarabe begin im career as account clerk from 1953 - 1955. E teach for school from 1955 - 1960. He hold plenty managerial positions from 160 to 1976 wen e dey study for different colleges for London to gain additional qualifications.

Abdulkadir Musa Balarabe political career and why dem impeach am as Kaduna state govnor

Dem elect Musa as govnor of Kaduna state for 1979 under di platform of di Peoples Redemption Party, di political party wey im and oda pipo like Aminu Kano, Micheal Imoudu, Chinua Achebe Sule Lamido Abubakar Rimi, Uche Chukwumerije join hand to build. But di opposition party for that time, di National Party of Nigeria bin challenge im election but dem no dey successful.

As govnor, di Kaduna State House of Assembly wey be say na NPN members full am no cooperate wit Oga Musa. Dem no allow am form im cabinet sake of say im refuse to nominate NPN members for di cabinet.

Las las, di house impeach am for June 1981 wey make am di first Nigerian state govnor to ever chop impeachment.

But oga Musa later tok say reason why di lawmakers remove am na because im plan to open small and medium size industries for di state and dis no go give NPN members opportunities to operate dia own business.

According to tori, he dey part of dos wey kick against di military junta of late Sani Abacha.

Im lead di Conference of Nigerian Political Parties (CNPP), a coalition of opposition parties, for di Fourth Republic.

Alhaji Musa Balarabe continue to dey active for politics before e begin get health challenges for 2018.

Tributes for Abdulkadir Musa Balarabe

Nigeria President Muhammadu Buhari for inside statement join oda Nigerians to mourn di late Balarabe Musa, wey im say all Nigerians go miss as a voice for the voiceless.

Other ogbonge politicians like di Kaduna state govnor, Nasir El-Rufai, former Lagos state govnor, Bola Ahmed Tinubu among odas also pay tribute to honour di late politician.