Hosni Mubarak: Former Egyptian president don die

Wia dis foto come from, Getty Images
Former Egyptian President Hosni Mubarak - wey military remove for 2011 - don die inside hospital for Cairo at di age of 91.
Mubarak bin spend thirty years inside office before one popular uprising alias Arab spring sweep Egypt.
Dem find am guilty of complicity inside di killing of protesters during di revolution. Dat court sentence na for March 2017 dem tumble and free am.
Im death na Egyptian state news confam am on Tuesday. Earlier in di day, di Al-Watan website report say im die formilitary hospital inside Cairo.
Mubarak bin do operation for late January.
Im son Alaa tok on Saturday say oga Mubarak bin dey inside intensive care.
Wetin you need to sabi about Mubarak
Muhammad Hosni Said Mubarak dem born am on 4 May 1928 at Kafr-El Meselha, inside northern Egypt.
Upon say e get poor background, e graduate from Egypt Military Academy for 1949. He transferr to di kontri air force, wia dem commission am for in 1950.
End of Di one wey oda users dey read well well
Mubarak na tough Egyptian General - wey rule from 1981 until dem overthrown am for 2011 in di middle of di Arab Spring protests wey happun across di middle east region.

Wia dis foto come from, Getty Images
We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.













